DJ wan comot album wey go make person sleep

Wia dis foto come from, Getty Images
How you think say concert for sleep music go be?
You go fit ask DJ Tom Middleton wey wan comot with album wey go help people to fit sleep wella.
Di name of di album na 'Sleep Better'.
Im talk say "I no want make you listen to my music" when im dey promote di song.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
E talk say na im waka with sleep as im dey do im work show am say e go like do music wey dey make people sleep.
Middleton don work with plenty foreign artistes like Kanye West, Lady Gaga and Snoop Dogg.
E work with brain scientist for di test on top di music whether e fit help people to sleep based on di beat of di song.
On whether e dey work, im talk say, "We don put warning say 'no listen to dis if you dey drive, work with machine or you dey under water'. As we dey work am e dey work. Heart rate dey reduce and people dey sleep."
End of Di one wey oda users dey read well well












