Florida shooting: Trump say Russia investigation cover FBI face

A young girl sits at a temporary memorial in Parkland, Florida. Photo: 17 February 2018

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 2 mins

US president Donald Trump dey shake head for di Federal Bureau of Investigation, FBI, on top how dia Russia investigation no let dem see road do dia work well.

Mr Trump write for Twitter say di agency "dey spend too much time to prove say Trump campaign join hand with Russia" for di 2016 election.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Im say make FBI go back to di job wey dem suppose do so Americans go dey proud of dem.

A protester chants during a rally in Fort Lauderdale, Florida. Photo: 17 February 2018

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Some young protesters cry as dem dey demand strong law wey go check as people dey buy gun

Di FBI don agree say dem no do well as dem no torchlight di mata when people bin report di shooter, Nikolas Crus, before im carry gun go kill people for high school for Parkland, Florida.

Dem bin warn di agency say make dem chook eye for Mr Cruz behaviour after im write plenty bad things for social media before im do di school shooting.

Ellie Branson is comforted as she joins with others after a school shooting that killed 17 to protest against guns on the steps of the Broward County Federal courthouse on February 17, 2018 in Fort Lauderdale, Florida

Wia dis foto come from, Getty Images

Na di school shooting wey worse pass since 2012.

Students wey survive di shooting gather for Florida to demand say government suppose change di law so e go hard for people to buy gun anyhow.

A woman carries a sign reading "reform gun laws", at the rally in Fort Lauderdale

Wia dis foto come from, Joe Raedle

But e be like Mr Trump dey connect how di FBI take miss di shooting to di investigation wey di agency dey do on top whether Trump campaign people follow Russia arrange di election wey im win.

Special Counsel Robert Mueller don charge 13 Russians and three Russian companies wey dem accuse say dem put hand for US election.