Germany coalition talk: Merkel ruling party and opposition SPD don agree deal

Wia dis foto come from, Getty Images
Germany opposition party, di Social Democratic Party (SPD) don reach agreement to form coalition government with Chancellor Angela Merkel centre-right (CDU/CSU).
Dis agreement delay until now because di two parties dey drag who go dey in charge of some major ministries.
Dis agreement go end months of fight-fight since di German election for September last year.
Na since Tuesday morning negotiators don lock diasef inside room, knack head together to find solution and as e be so, e be like say new government fit begin run things by Easter.

Wia dis foto come from, AFP
Wetin dem agree?
As things dey ground, di main opposition party, SPD fit control six ministries wey go include finance and foreign affairs.
German media dey talk say party leader, Martin Schulz, dey eye di foreign minister job for imself.
But dis agreement go still need di final green light of di SPD 460,000 members, wey go vote in few weeks time.
End of Di one wey oda users dey read well well
One group inside di SPD wey dey call diasef, NoGroKo, don talk say dem no wan make SPD follow di CDU/CSU do coalition.











