"Beyonce light skin dey help her career" - Beyonce papa

Wia dis foto come from, Getty Images
Di papa of popular America singer, Beyonce, don talk say di light skin wey im daughter get follow help her career.
Mathew Knowles, Beyonce papa wey dey manage im daughter before, dey carry di tori give Ebony magazine.

Wia dis foto come from, Getty Images
For di interview, im talk about how im take grow up for di South of US and how im mistake think say im former wife and Beyonce mama, Tina Knowles, na white woman.
Ebony magazine ask am wetin im think on top how colour dey affect upcoming artists as dem dey try enter di main music industry.
"For black females, who be di people wey radio dey jam dia music pass? Mariah Carey, Rihanna, di female rapper Nicki Minaj, my pickins dem (Beyonce and Solange), and wetin all of dem get in common?"
Reporter: "All get light skin."
Knowles: "You think say na by mistake?"
Reporter: "No be so!"
End of Di one wey oda users dey read well well
Knowles: "You see am so."












