Albert Einstein 'happiness' notes don sell for $1.5m

Wia dis foto come from, AFP
E don tey wey plenty people don dey search for happiness, but e be like say two people wey get money don buy am.
One note wey scientist Albert Einstein write many years ago don sell for one auction house inside Jerusalem for $1.56m (£1.19m).
Einstein been give di notes where im describe im theory for happy living to one man wey go message for am, wen e dey one Hotel inside Tokyo for 1922, as e no get money to give am as tip.
During dat time, Einstein wey be scientist just hear say im win di Nobel prize for physics, wen im been dey Japan for tour.
Wen di Japanese courier come di Imperial Hotel for Tokyo to deliver message to am, Einstein tell di messenger say, if e dey lucky, di notes go become big value wey pass di tip.
Einstein suggest for di notes say to achieve di goal wen person don dey dream of to get for long time, no be guarantee to happiness.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin Albert Einstein write inside di two notes?
Albert Einstein use di stationery from di Imperial Hotel Tokyo wey im lodge take write di note for Germany Language. E write say:
"A calm and humble life go bring more happiness than di pursuit of success and di constant restlessness wey dey come with am."
Second note wey im write for di same time be:
"Where will dey, way go dey."
Dis second one sell for $240,000, according to wetin di Winner auction house talk.

Wia dis foto come from, Getty Images
How di auction be
According to di people wey sell di note, di winning bids for di two notes dey far higher than di price wey dem first been feel say dey go sell am.
Dem say di person wey buy one of di notes na European wey no want people to know say na im buy am.
Di person wey be di seller, tori say na nephew of di messenger.












