Las Vegas shooting: Stephen Paddock kill over 50 people

Wetin we call dis Video, Las Vegas shooting: Stephen Paddock kill over 50 people

Na gunshot drive many people to run for their life, during music festival for Las Vegas, US.

People wey see as e happen say di shot wey di suspect fire reach hundreds.

Police don identify di gunman as 64-year old Nevada resident Stephen Paddock.

Dem say im open fire from di 32nd floor of Mandalay Bay Hotel on top di open air music festival, where 22,000 people gather.