UK: No licence for Uber to operate for London

Wia dis foto come from, PA
Transport for London (TfL) shock many people today, when dem announce say Uber no dey "fit and proper" to get London private hire operator licence.
Dem say dem take di decision because of "public safety and how e fit affect security matter."
Their concerns include di way Uber take dey do background checks on drivers and di way dem dey report serious criminal offences.
Uber current licence go run until 30 September; dem get 21 days to appeal against TfL decision and dem go fit continue to operate while any appeals dey on.
According to di statement wey Uber carry come out, dem say: "Transport for London and di Mayor don listen to small number of people wey no want consumer to get choice."
Dem say e show di world say London no dey open to companies wey dey bring change.

Wia dis foto come from, PA
Uber general manager for London wey be Tom Elvidge talk say: "To defend all di drivers wey dey use Uber take dey find their daily bread, and di choice of plenty-plenty Londoners who dey use our app, we dey plan to challenge dis decision for court immediately."
E say Uber dey operate for more than 600 cities around di world, including more than 40 towns and cities wey dey for di UK.
End of Di one wey oda users dey read well well
About 3.5 million passengers and 40,000 drivers na im dey use di Uber app for London.
How people don react for London
Plenty people don dey react differently on top dis Uber matter. Celebrities, Uber drivers and those wey dey use am don talk their own.

Wia dis foto come from, KathyBurke/Twitter

Wia dis foto come from, Piers Morgan/Twitter

Wia dis foto come from, katie Hopkins/Twitter

Wia dis foto come from, Mx james le lacheur/Twitter

Wia dis foto come from, Duncan James/Twitter
One driver with Uber for London talk say e no think say dis na fair decision. E say Uber dey offer easy plan, and im dey allow people dey make money every week.
Meanwhile Uber don pass though some challenge before for some Africa countries. For March dis year, taxi drivers inside South Africa do protest against di company, where dem block airport roads, while Uber drivers also suffer attack where drivers for Kenya put fire for dia car.











