US go "totally destroy" North Korea - President Trump

Wia dis foto come from, Getty Images
President Donald Trump give him first speech to United Nations General Assembly on Tuesday and na Iran and North Korea im carry for mind take start.
"Rogue government dem wey send representative for here no dey only support terrorists, but dem dey threaten other country dem and dia own people with killer weapons wey human beings never see before."
Trump attack di government of North Korea, (wey UN don already ban) im come talk about di America person wey die after North Korea capture am.
Im even talk say na North Korea kill Kim Jong Un brother.
Di US president warn say im country go "totally destroy" North Korea if dem force America with dia threat and nuclear program.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin else Trump tell UN General Assembly?
Trump speech focus on top terrorism and nuclear power of country dem wey dey vex for US.
But im talk say very soon US military go be di strongest wey people never see before.
After im list international criminal networks wey dey traffic drugs, weapons and people as some of di wahala country dem dey face for dia border, Trump say UN members must all "respect di interests of dia own people and di rights wey other independent country get."
End of Di one wey oda users dey read well well
Di US president add say, come rain, come sun, as long as im be President, im go defend America interests above every other country.
Im chook mouth on top country dem wey get strict powers say as dem dey go, e be like say dem wan scatter di values, systems, and agreement to avoid wahala since after World War 2.
Trump say America go stop wetin im call "radical Islamic terrorism because dem no go allow dat kain tin to tear up dia country or tear up di whole world."










