Photo: Big flood don land for Houston

Dis na Pictures from the fourth largest city for US wey dey battle with big flood.

Picture of di city as flood water almost reach billboard for road

Wia dis foto come from, AFP/Getty

Wetin we call dis foto, Water dey deep for some place for Houston sotey e dey almost reach billboard
Picture of road wey just dey under water

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Flood water don full many of di road wey dey for di city
Flood victms wey wear Red Cross blanket dey look for wia to stay for one place for George R. Brown Convention Centre

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Dem don set up place wia people fit stay including for one convention centre
People wey flood affect dey receive food for one house for George R. Brown Convention Centre

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Officials dey expect 30,000 wey go stay for emergency house
Motor wey dey inside water as rain dey fall

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Many motor just dey inside water across di city. Rescue workers even free di people wey drive dem.
People wey dem rescue dey come down from helicopter

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Coastguard follow dey rescue people wey no get wia to go.
One man and pickin inside helicopter

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Helicopter jack people up from ground to carry dem comot
Couple wey carry box with two dog inside

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For many people wetin just dey dem mind na to rescue dem pet before property
Dem dey move one woman wey dem rescue from boat to Kayak for Dickenson, Texas (27 August 2017)

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Emergency 911 people for Houston receive 56,000 calls over 15 hours- seven times more than wetin dem dey receive for normal day.
Picture from up show how flood don take over Houston

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Picture from up dey show tall-tall buildings wey water don cover for Houston
One woman and her dog dey wait for help on top one airbed wey dey float

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One woman and her dog dey wait for help on top one airbed wey dey float
Dem carry one woman wey dem rescue from hotel with boat because of heavy flooding

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, For tori conference, di Federal Emergency Management Agency tell ordinary citizens to "get involved" for di rescue effort