Kogi state election update, Bayelsa, Imo and all di tins wey don happun for di 2023 governorship elections

Wia dis foto come from, Dino, Uzodinma, Diri and Sylva/ Fascebook
Di Independent national electoral commission don declare Hope Uzodimma of di All Progressives Congress as winner of Imo state govnorship election.
INEC declare Govnor Uzodimma winner on Sunday a day afta di election take place on 11 November.
Govnor Uzodimma gada 540, 308 votes to defeat im closest rivals, PDP Anyanwu, wey get 71,503 votes and LP Achonu wey get 64,081.
Below na some of di tins wey don happun so far for Imo, Kogi and Bayelsa govnorship election.
Labour party agent chop beating for Imo

Di agent for Labour Party, LP for di govnorship election chop beating afta im challenge di election result.
Dem beat Calistus Ihejiagwa well-well before dem carry am comot for di collation afta im bin claim say di result for di collation centre dey different from di one wey dey uploaded for (IReV).
Dis incident happun before di state Returning Officer for di election, Vice Chancellor of di Federal University, Oye Ekiti, Prof Abayomi Fashina, Police oga and oda ogbonge pipo wey dey part of di election for Imo state.
All dis happun before dem announce di winner of di election.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kogi 'forged election result'
For Kogi, di state collation centre open on Saturday evening for di govnorship election afta voting end.
Nothing really happun dia until Sunday morning, wen di results for di 21 local goment areas begin enta from di 18 candidates wey contest for di election.
But di major drama wey happun during election for di north central state na di issue of di 'forged result'.

Wia dis foto come from, YIAGA Africa
Na one civil society organisation for di kontri first raise alarm ontop di 'forged election results' for some polling units.
YIAGA Africa say dem receive report of results sheets wey dey filled for PU 004, Eni Ward of Ogori/magongo area for di north central state.
Afta dey raise di alarm, na im INEC chook mouth for di mata. INEC say: ''Our senior officials for di state dey torchlight di mata.
'Di commission go share di decision very soon''. INEC add put as dem address di mata.
Later, di election join body release statement say dem don suspend election for di nine wards wey dey Ogiri/Magongo local goment area of di state.
Di wards na Eni, Okibo, Okesi, Ileteju, Aiyeromi, Ugugu, Obinoyin, Obatgben and Oturu.
INEC say dem take dis action afta dem receive reports of electoral malpractices, especially cases of result sheet before voting from dia officials for Kogi state.
"Reports show say incidents occur for Adavi, Ajaokuta, Ogori/Magongo, Okehi and Okene local goment areas. Di most serious incidents occur for Ogori/Magongo, wey affect nine of 10 registration areas."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
INEC say dem dey investigate cases of electoral fraud for oda local goment areas.
Dem add say dem get record of all officials dem deploy go di state and di election materials dem give dem and appropriate sanctions go dey applied wia necessary.
Di commission assure voters for Kogi state say dia votes go dey protected and dia wishes go dey respected.
Meanwhile, security agencies use trucks block roads to restrict movement and travels to oda states.
BBC crew bin try to visit Obajana local government area to chook eye for wetin dey happun dia but security personnel say, "We purposely use truck block di road to avoid interstate travels"


Bayelsa 'hostage palava'
Elections no too smooth for Bayelsa sake of security challenge wey happun for di south-south state.
On Sunday, INEC raise alarm say armed men hold dia officials hostage for Brass local goment area of Bayelsa state.
Dis na as collation of govnorship election results dey go on for di state.
Di commission say di situation dey detrimental to credible elections for di state.
INEC call on security agencies to immediately facilitate di release of di officials.
Earlier on Sunday, many supporters of di PDP carry protest go INEC headquarters for Yenagoa di state capital.
Dem dey protest say some alleged supporters of di APC no allow dem participate for di elections for Nembe-Bassambiri.
Di protesters wear black on black and block di road but di security pipo on duty for Inec no allow dem come near di headquarters.
Dis affect movement to di Swali axis of Yenagoa as di protest make dem no allow vehicles to pass and e make dem increase security vigilance for di area.
We need to stop off-season Elections for Nigeria - Ex President Jonathan

Wia dis foto come from, Goodluck Jonathan/Facebook
Meawnwhile, former President Goodluck Jonathan call on di National Assembly to stop off-season elections for Nigeria.
Jonathan tok dis one afta im vote for di governorship election for im hometown of Otuoke, Ogba LGA Bayelsa State.
E say off-season election no be best global practice, e ask di National Assembly to do something about am so dat evri state for Nigeria go do election di same time.
"If we continue wit dis trend of off-season election based on di interpretation of our laws by di Judicial officers, e go come to a time wen even di presidential election maybe season." Na so e tok.
Di former Nigerian leader urge citizens for states wia govnorship elections dey hold to dey lawful as dem dey carry out dia civic duties.











