Sudan crisis: Nigeria goment give update on evacuation plan

Wia dis foto come from, Reuters
To carry Nigerians comot from Sudan inside di fight-fight wey dey happun no be small operation, na so Nigeria goment tok.
Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) give di explanation as pressure kontinu to mount on goment to find how to carry Nigerian citizens comot from Sudan.
Abike Dabiri-Erewa di oga of Nidcom for interview wit di BBC say di process of evacuating pipo from Sudan no dey as easy as pipo dey tink am.
She say as tins be now, Nigerian goment must get permission from di two generals wey dey fight over Sudan future.
"We dey hope say by tomorrow (Tuesday) di first set of buses go leave Khartoum towards Cairo to move some of dem to a safe place bifor we airlift dem back to Nigeria.
"Contact dey for di Nigerian mission for Sudan wey students go meet and di bus go carry dem from dia.
"Why we dey take our time na becos we must get permission of di military on di two side.
"We get plenty students for dat kontri. We dey tok of thousands wey mean say we go transport dem wit plenty buses. We no wan put any of dem in danger," she tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dabiri-Erewa add say Nigeria foreign affairs ministry don reach out to di rival groups make dem fit "give us safe corridor to carry our pipo comot."
One Nigerian student wey dey study for Sudan say di situation dia dey worse more and more.
Di lady wey no tok her name for di video wey don go viral say she and her family run from Khartoum di capital sake of her sister wey dey sick.
She say di hospital dia no dey work to treat her sister sake of di fight-fight.
Di lady wey wear grey veil for di viral video say she and her family dey di border town for Al Qadarif.
72-hour cease fire for Sudan

Wia dis foto come from, Getty Images
Ceasefire wey start on di midnight of Monday don take effect for Sudan.
Dis na like di third time dem go suspend di fight-fight since violence erupt start dis month.
US Secretary of State Antony Blinken say di 72-hour pause in fighting na agreement between di army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) afta 48 hours of negotiations.
At least 400 pipo don die since fighting start on 15 April.
Di two side don independently announced dia involvement in di ceasefire.
Dem run go di border as many pipo including Sudanese dey leave di capital city.
Heavy fighting dey go on for di African kontri sake di power struggle for di military leadership of di kontri.
Na about 420 pipo don die since di war start for April 15 between di Sudanese army and RSF paramilitary force.
Dem don airlift more dan 1,000 EU citizens, most of dem on French and German rescue missions.
Di UK bin evacuate diplomats and dia families yesterday, but about 4,000 British citizens still dey di kontri.
Who dey fight who for Sudan?

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Sudan army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) don dey fight since Saturday for clashes wey don kill at least 270 pipo.
Since di 2021 coup for Sudan, na council of generals wey two military men dey lead dey run Sudan.
Dis two military men na dem dey di centre of di crisis inside di kontri.
Gen Abdel Fattah al-Burhan, wey be di head of di armed forces and in effect di kontri president.
And im deputy and leader of di Rapid Support Forces (RSF) Gen Mohamed Hamdan Dagalo, wey dey known as Hemedti.
Two of dem disagree with each oda on di direction wey di kontri dey go and di plan move to bring civilian rule.
Di main issue na plans to include di 100,000-strong RSF into di army, and who go then lead di new force.
Wetin di two sides want?

Wia dis foto come from, Getty Images
Sudanese army soldiers, loyal to army chief Abdel Fattah al-Burhan, pose snap foto for di Rapid Support Forces (RSF) base for Red Sea city of Port Sudan, 16 April 2023
Gen Dagalo don bin tok say di 2021 coup na mistake and don try to present imsef and di RSF to show say dem dey di pipo side, against di Khartoum elites.
While e get some support, odas find dis message hard to believe sake of di paramilitary force wicked track record.
Meanwhile, Gen Burhan don bin tok say di army go only fully hand ova power to elected goment.
But suspicion dey ground say both military men, and dia supporters, dey worried about wetin fit happun to dia wealth and influence if dey remove dem from dia powerful positions.











