Peter Mbah win Enugu governorship election 2023 as e beat Labour Party Chijioke Edeoga

Peter Mbah of di Peoples Democratic Party and Chijioke Edeoga of di Labour Party

Wia dis foto come from, Mbah/Edeogah/Facebook

Di Independent National Electoral Commission, Inec don announce di Peoples Democratic Party, PDP candidate Peter Mbah di winner of di Enugu state govnorship election afta days of delay.

Inec say e poll 160,895 to defeat im closest challenger Chijioke Edeoga of di Labour Party wey poll 157,552 votes.

Enugu for Southeast Nigeria follow for di four states of di kontri wia Inec bin neva declare di final result.

Di four states wia di election bin drag na Abia, Enugu, Adamawa and Kebbi. But Inec don announce dat of Abia and Enugu now while dat of Kebbi and Adamawa dey inconclusive.

Tension bin dey di two eastern states sake of allegation say some political parties wey dey lose dey try to do mago-mago wit di results.

Di election for Enugu

Na 18 candidates contest di governorship election for Enugu state.

Out of di 18 candidates di result wey Inec bin first announce narrow down di number of di main candidates to two.

Peter Mbah of di Peoples Democratic Party and Chijioke Edeoga of di Labour Party.

Di Southeastern state also get 18 Local goment areas -Inec bin declare results of 16 LGAs - remaining two.

Inec National Commissioner Festus Okoye say dem bin suspend di collation of results for Nkanu East and Nsukka, to allow di commission review di results before dem announce dem.

Four days afta di election wey bin hold on 18 March, Inec announce say dem go do di final collation on Wednesday.

Who be Peter Mbah?

Peter Ndubuisi Mbah na lawyer wey own or dey on di board of several companies wey include Pinnacle Oil and Gas Ltd.

Im bin serve as di Commissioner of Finance and Economic Development under Govnor Chimaroke Nnamani.

E also serve as di Chief of Staff to di govnor of di state for 2003.

Move around di map to see di results local goment by local goment as Inec declare am

Your device fit no support this visualisation