Christian Atsu: Body of late Ghanaian player land for Kotoka International Airport

Ex Black Stars player, Christian Atsu

Wia dis foto come from, Getty Images

Di deadi body of di late Ghanaian footballer wey die for de Turkiye earthquake, Christian Atsu don arrive in Ghana wia dem go bury am.

Dem bin see di player deadi body under di rubble on Saturday morning.

Atsu body arrive at 7:25 pm local time on Sunday onboard a Turkish airliner.

Family members, govment and Ghana FA officials, receive am.

Dem go later transport di to one military hospital morgue for di capital of Accra.

Christian Atsu profile

Christian Atsu bin player for Premier League

Wia dis foto come from, Christian Atsu/Twitter

Wetin we call dis foto, Christian Atsu bin player for Premier League

Atsu na former Black Stars footballer wey don play for football clubs like FC Porto, Chelsea, Newcastle, Everton den Bournemouth.

Di 31-year-old footballer bin take short break from Ghana National team to focus on building im career at club level.

Dem born am on 10 January 1992 and e start im career for Porto, where e later spend one season on loan for Rio Ave.

For 2013, Chelsea sign am for £3.5 million and dem loan am to Vitesse Arnhem, Everton, AFC Bournemouth den Málaga.

After Atsu spend di 2016-17 season on loan for Newcastle United, e complete im permanent transfer to di club for May 2017.

As an international player e play over 30 caps since e join Black Stars for 2012.

Atsu represent Ghana for di 2014 FIFA World Cup and two Africa Cup of Nations tournaments.

E help di team finish as runners-up for di 2015 Africa Cup of Nations where e win Player of di Tournament and Goal of di Tournament awards.

Na three pikin dem and one wife survive di late footballer.