Obasanjo, Charly boy video: 'I be di father of frustrated Nigerian youths' OBJ tell Areafada

Obasanjo, Charly boy video: 'I be di father of frustrated Nigerian youths' OBJ tell Arreafada

Wia dis foto come from, Screenshot/Instagram

Wetin we call dis foto, Charly Boy go visit Obasanjo on Friday 19 August for im domot for Ogun State, inside southwest Nigeria.
Read am in 4 mins

Olusegun Obasanjo say im be di 'father of frustrated youths inside Nigeria..

Di former Nigerian president make dis claim during di visit of veteran entertainer, Charly Boy, to im residence on Friday.

For di video wey Charly boy post for im instagram account, Obasanjo dish out advice to di 'frustrated Nigerian youths,' as papa wey e be to dem.

Charly boy start by passionately introducing imsef as di president of di group saying;

"If as di president of frustrated youths of dis kontri, na me be dia president. Me myself I dey frustrated.

Later on, Obasanjo come chook mouth for di conversation and ask Charly boy say; "You be president of frustrated Nigerian youth?" which e reply 'yes.'

Den di former president come tell am say; "Na me be di father of frustrated youths of Nigeria."

During di visit, wen Charley boy ask di former president to advise di "frustrated Nigerians" Obasanjo tok say,

"Dat we dey poor and frustrated no be di fault of God, na di choice of our leaders."

"And if you want to change dat and change our situation, you gatz to change leadership. Pure and simple.

"And e no get anybody wey go do am except di youths."

Obasanjo come later describe Nigeria as im own baby wey e go like to put beautiful bead on her waist and no be for any individual body.

Nigeria population wey be youths

E get about 109,810,327 pipo wey dey over age 18 inside Nigeria, according to one worldometer report.

Na from 18 years and above dem dey reason say pesin don be youth inside di west African kontri.

Dis number fit form half of Nigeria population wey dey projected at ova 200 million pipo, according to UNFPA.

Also, according to di United Nations Population Fund (UNFPA) 54% of di kontri population dey between di age of 15-64.

Wen e come to di average of a Nigerian citizen, di kontri dey relatively young.

Na multiple ethnic groups dey Nigeria and di most common non-English language dem include language of Hausa, Yoruba, Igbo and Pidgin.

Life expectancy inside Nigeria dey low in inside West Africa, data show.

Di average life expectancy dey around 54.5 years of age according to WHO data, wit men living an average of 53.7 years and women living 55.4 years.

Dis fit be unto say di kontri get a lot of health issues, public infrastructure palava,unemployment, inflation, and security challenges.

Nigeria get di largest population in Africa. United Nations dey guess say di overall population of Nigeria go reach about 401.31 million by di end of di year 2050.

Dis population growth no equal di level of development and cost of living in living.

Cost of living tough - Nigerian leader admit

Meanwhile President Muhammadu Buhari confam say urgent need dey for a general salary review of Federal Public Service workers.

Di Nigerian leader say di need to increase pay na due to worldwide problems of high inflation amidst general economic disruption.

"However, I wish to beg una to appreciate di revenue constraints wey Goment dey presently face caused mainly by di activities of jaguda pipo wey dey tiff our crude oil, a main contributor to our income base.

"Di mata even dey complicated sake of global economic downturn as a result of di on-going Russian - Ukrainian war, wey don lead to price increases...

"Not just di costs of goods and services globally, but also ontop transportation of dis goods and services across di world." President Buhari tok.

Di Nigerian leader reveal dis wen di Central Working Committee of Association of Senior Civil Servants of Nigeria visit am for di presidential palace inside Aso Rock on Friday, same day Charly Boy visit ex-president Olusegun Obasanjo.

Charly Boy, who e be?

Charly Boy AKA Area-Fada na long time ogbonge Nigerian entertainer and activist.

Him be di son of late Nigerian jurist Chukwudifu Oputa, di oga of Oputa panel wey sit for 1999 national conference Nigeria do.

Oputa panel bin investigate human right abuses by former military juntas and submit dia findings in 2003.

Area-Fada, as e dey call im sef, like to chook mouth for issues wey concern social justice and leadership in Nigeria.

Close to di last election circle across Nigeria, Charly boy bin champion one movement dem call "our mumu don do".

Dat movement dey similar to dis latest one wey e dey call imsef president of di frustrated Nigerian youths.

And by di way, no existing group dey official named as such, but di entertainer fit don come up wit di idea sake of di way tins dey fail for Nigeria.

Olusegun Obasanjo

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Olusegun Obasanjo na retired army general.

Olusegun Obasanjo profile

Olusegun Obasanjo aka Baba OBJ (as many dey call am) don serve as Nigerian military and civilian leader.

Di retired general served as Nigeria head of state from 1976 to 1979 and later as President from 1999 to 2007.

Di 85 year old former leader dey known for im open-letters to sitting Nigerian presidents to address poor governance or challenging social issues.

Dis no be di first time Obasanjo dey address leadership failure.

E get time wen e hala say; Muhammadu Buhari no go dey good to handle Nigeria economy, as president.

Only recently e cry out ova di cost of living in Nigeria wen e complain about di cost of diesel and how e dey affect im farm business.

Chief Olusegun Obasanjo na respected personally across Africa.

Who be youths?

United Nations define 'youth' as those pesin between di ages of 15 and 24 years.

But many kontries also draw di line on youth with regard to di age wey pesin fit get equal treatment under di law

Often dem dey refer to am as di 'age of majority.' Dis age na commonly 18 years for many kontries.

So once pesin reach dis age, he or she go dey considered to be adult.

However, di operational definition of di term 'youth' different from kontri to kontri.

E dey depending on relative sociocultural, institutional, economic and political factors.