William Ruto rise from chicken seller to Kenya president-elect

President-elect Williams Ruto

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

President-elect William Ruto don give im very first speech afta di Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC) declare am winner of di 2022 Kenya election.

E narrowly beat im rival Raila Odinga wit 50.49% of di vote.

For di speech e take address di nation, Ruto promise to run transparent, open and democratic goment.

Di 55 year old president-elect also promise all di pipo of of Kenya - whichever way dem vote - dis goment go be dia own.

"I go run a transparent, open and democratic government," e tok.

"I wan promise all di pipo of Kenya - whichever way dem vote - dis go be dia goment.

"I want tell dem [opponents] say dem get nothing to fear - no room for vengeance. I dey very aware say our kontri dey for di state where we need all hands on deck to move it forward.

"We no get di luxury to look back. We no get di luxury to point fingers. We get di luxury to apportion blame. We must… work together for a functioning, democratic, prosperous Kenya. Williams Ruto tok.

Di President-elect for im thanksgiving to di pipo of Kenya, di IEBC and all im partners hail dem and acknowledge say na God win.

"I know say predictions dey say we no go get here but because God dey for heaven we dey here. I now confess say without God we for no dey there.

E add say dis election don raise di bar for di kontri as no be about ethnicity but issues.

President-elect William Ruto go be di fifth elected president since independence.

Profile: Who be William Ruto?

Kenya president-elect

Wia dis foto come from, Williams Ruto

William Ruto - wey just dey declared winner of Kenya heavily disputed presidential election - get di same childhood wey be like dat of many poor Kenyans.

E go primary school without shoes. E wear im first pair of shoes for di age of 15. E bin also sell chicken and groundnuts for roadside for rural areas of di Rift Valley.

So e no come as surprise say e show himself as di champion of di poor as as e vie for di presidency for di 9 August election.

Oga Ruto contest under di banner of Kenya Kwanza, Swahili for Kenya First, wit a promise to grow di economy.

Dis na di first shot of di 55-year-old at di presidency and e shock im critics by achieving victory - though in a stunning development,.

E join politics in 1992, having been mentored, he tok, by then-President Daniel arap Moi.

Oga Ruto bin dey part of di youth wing of Mr Moi once-dominant Kanu party, and dey among di activists wey dey tasked wit mobilising voters for di kontri first multi-party elections wey hold for di same year.

E get di reputation of being a powerful orator wey dey draw huge crowds for rallies and dey put up strong performance in media interviews.

E dey often start to tok by saying "My friend", wey dey always help am strike rapport wit voters and disarm critics.

Shifting alliances

Mr Kenyatta (R) and Mr Ruto be formidable team until dem fall out

Wia dis foto come from, AFP

Afta holding various ministerial posts - wey include education and agriculture - he rise to di position of di deputy presidency afta di 2013 election.

Mr Ruto contest dat election as di running mate of outgoing President Uhuru Kenyatta, dis come as shock for many Kenyans as dem bin dey on opposite sides of political spectrum for di previous election.

Na alliance of convenience, as both of dem dey charged by di International Criminal Court (ICC) wit crimes against humanity afta dem chop accuse of fuelling violence in di aftermath of di heavily disputed 2007 election, wey lead to di death of about 1,200 pipo.

For dat poll, Mr Ruto bin support opposition candidate Raila Odinga - wey lost to am dis time round - while Mr Kenyatta support then-President Mwai Kibaki for im re-election bid.

Dia alliance, wey pipo call bromance, pay off as di two men swept to power, put dem for strong position to throw way di threat ICC pose give dem.

However, dia relationship scata for 2018 when Mr Kenyatta - in yet another stunning about-turn - reconcile wit Mr Odinga, dis dash Mr Ruto wey dey hope say di outgoing president go endorse am as his successor for di current election campaign.

Di president allies accuse Mr Ruto of insubordination, allegation wey he deny, but he acknowledge di disagreement as e say im and di president "see politics differently".

Oga Ruto remain for office, however, courtesy of constitutional provisions wey secure di tenure of a deputy president.

Big landowner and keen farmer

Mr Ruto give out wheelbarrows to youths to promote im image as a "hustler"

Wia dis foto come from, KENYA DEPUTY PRESIDENT OFFICE

Ethnic loyalties dey play huge role for Kenyan politics and Mr Ruto come from di third biggest ethnic group, di Kalenjin, wey don produce only one oda president, di late Mr Moi, wey be Kenya longest-serving ruler.

Mr Ruto dey married to Rachael, wey e meet for church youth meetings.

Dem get six children. Dia eldest son, Nick, was once blessed by Kalenjin elders, wey fuel speculation say dem dey groom am for a political role, while dia daughter, June, dey work for di foreign affairs ministry.

Mr Ruto get passion for agriculture, e dey into maize, dairy and poultry farming.

E get huge parcels of land for western and coastal Kenya and don also invest for di hospitality industry.

Mr Ruto dey linked to corruption scandals for goment and di source of im wealth na subject of much speculation.

In June 2013, di High Court order am to surrender a 100-acre (40-hectare) farm, and compensate a farmer wey accuse am of grabbing di land during di 2007 post-election violence.

E deny any wrongdoing, and beg voters wit a promise to give dem opportunities to improve dia lives, just like am.

Reactions trail Ruto win

William Ruto collect certificate of return from IEBC

Wia dis foto come from, WILLIAM RUTO

Na delight, joy and happiness for William Ruto party headquarters for Nairobi, wia pipo don begin scata dance afta e win di election.

Leaders across African nations don begin send congratulatory messages to President-elect, Williams Ruto

Emmerson Mnangagwa, di president of Zimbabwe, don welcome di news say William Ruto go be Kenya next president.

"I no dey doubt, e go serve im kontri, im pipo and our continent wit distinction", e tok for tweet.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Ethiopia Prime Minister Abiy Ahmed don also congratulate Kenya President-Elect William Ruto.

Mr Abiy tweet say im dey look forward to working closely with am.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Kenya Tourism Minister Najib Balala na di first cabinet minister to congratulate William Ruto.

Oga Balala dey among ministers wey no openly campaign for President Uhuru Kenyatta candidate Raila Odinga.

Oga Ruto during im campaigns bin call out ministers who wey dey attend im opponent campaigns and e accuse dem of politicising di cabinet against di law wey stop public servants from engaging in politics.

Somalia president say he "warmly congratulates" Kenya president-elect, William Ruto.

Di East African neighbours get close connections but diplomatic relations don dey in recent years, partly over a maritime territory dispute.

Di tweet from di Somali president office pointedly called for "stronger bilateral relations" and greater cooperation:

See results of di presidential elections

Kenya presidential results 2022

In order to win for di first round, one candidate must get 50% plus one of di cast vote and at least 25% of di votes inside 24 out of 47 counties


Last update: 15/08/2022, 18:59:32 EAT

Final results from IEBC

CandidatesVote
William Ruto
50%
50.5%
7,176,141
William Ruto
7,176,141
Kenya Kwanza Alliance
Votes: 7,176,141
At least 25% of county votes 39/47
Railia Odinga
48.8%
6,942,930
Railia Odinga 6,942,930
Azimo la Umoja Coalition
Votes: 6,942,930
At least 25% of county votes 34/47
George Wajackoyah
0.4%
61,969
George Wajackoyah 61,969
Roots Party
Votes: 61,969
At least 25% of county votes 0/47
David Mwaure
0.2%
31,987
David Mwaure 31,987
Agano Party
Votes: 31,987
At least 25% of county votes 0/47
Other candidates
0.6%
93,956
Other candidates 93,956

Move around here to see how dem vote county by county