Uduak Akpan Video: Iniubong Umoren murderer try to run afta judgement before dem remove am from court

Small drama happun for court wia Justice Bassey Nkanang of di Akwa Ibom State High Court sentence Uduak Akpan to death by hanging for di murder of late Iniubong Umoren.

Umoren, be graduate of Philosophy, University of Uyo wen Uduak kill am wen she go on a job hunt for April 2021 as she dey wait for NYSC mobilization.

Meanwhile her brother Ukeme, say di family dey happy now as im sister don get justice.

"I no believe say justice dey for common pipo wey be like us. All our hopes bin dey lost say dem go just do magomago wit di case as we no get pipo, but thank God say dem don give us Justice. You no fit kill my sister, bury am and go like dat. All di family dey happy wit dis judgement." Ukeme tok.