ASUP going on strike 2022: Academic staff Union of Polytechnics declare nationwide strike

Is ASUP going on strike 2022? Polytechnics Lecturers plan to begin strike see wetin next

Wia dis foto come from, Other

Academic staff Union of Polytechnics on Wednesday May 11 2022 declare to begin nationwide strike.

Na wetin Anderson Ezeibe wey be National president tell BBC Pidgin on Wednesday evening.

Ezeibe say ASUP take di decision to begin di strike for Abuja, di kontri capital.

Di reason for dia strike na say goment fail to implement di agreement wey dem reach last year., im add.

E say di strike go begin from Monday di 15th of May and e go last for two weeks.

Dis mean say Nigerian public university and polytechnic students go sidon for house.

Already di lecturers union for universities - Academic staff Union of Universities [ASUU] already dey strike for months now.

Di National president of ASUP say dem go review dia next line of action afta di end of di warning strike.

Im say dia action dey necessary since di four-week notice of strike di union give di federal goment to meet dia demand don expire.

E explain say di notice period bin start for April 4, 2022 and end for May 4, 2022. And di one month wey dem get to respond don expire.Comrade Anderson Ezeibe confam say "National Executive Council bin sidon on Wednesday 11 May to review di reaction of di goment to di ultimatum."

And afta di review di education join bodi no dey happy wit di position of di goment and sake of dat dem decide to do warning strike.

"Afta di two weeks di Union executives go meet again as dat go be di period of our 103rd executive council meeting".

Na for dia dem go review di reaction of di goment again, if di unioin no dey satisfied dem go decide further action.

Dis na as di Union National Executive Council go meet and one of di option before di union be to deploy industrial action. Ezeibe add.

ASUP going on strike 2022: Nigerian polytechnics lecturers declare nationwide strike

Wia dis foto come from, Other

E also add say "as at today we never receive any tangible evidence say dem don fulfil any portion of any unfulfilled aspect of di agreement.

"But we believe in miracle. Anything fit hapun bifo di time of our meeting tomorrow". Anderson add.Oga Anderson say, "Di Federal Ministry of Education don fail to carry out di decisions wey dem reach wit our union.

"And no gree act on di approval of di president for release of revitalisation funds for di sector".

Also "Di na di same ministry dey cause gbege of appointment of principal officers for polytechnics wey dey also supervise multiple infractions on di provisions of di Federal Polytechnics Act," di union leader add.

E say goment no also release 10 months arrears of di minimum wage wey dem owe of dia members. And many some oda tins wey bin dey di agreement.

Di ASUP strike dey start days afta Academic Staff Union Of University begin a third round of strike afta dem tok say goment no gree meet dia demand.

Is ASUP going on strike 2022? Polytechnics lecturers plan to begin strike, see wetin next

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin ASUP dey demand?

Ezeibe say dem dey fight for three main agreements.

Di first na di revitalisation funds wey goment promise to give dem but dem neva see shi-shi.

E say out of di 800 billion naira wey dem ask goment to take revitalise di sector, goment only agree to pay 15 billion naira, but dem neva see one kobo.

Di second tin dem dey fight for na renegotiation of conditions of service.

According to di national president, since dem begin dis discussion wit di goment for December 2021, di tok neva move forward.

In fact, dem neva even begin any serious tok for di mata, im add.

Di third important mata na issue of minimum wage.

Goment owned polytechnics for Nigeria gada millions of students across di west African kontri.

Wit di ongoing university lecturers union [Asuu] strike, if polytechnic lecturers (Asup) also down tools, e go see a lot of tertiary institution students out of school.

For many years now, lecturers for public universities and polytechnics don dey demand for beta welfare package from goment.

But, di Nigeria federal goment failure to honour agreements with di lecturers wey concern dia welfare, don make dis unions to go on many strikes.

As a result, students of goment owned tertiary institutions no dey fit complete di stipulated years of dia course at once sake of dis strikes.

Wetin pipo go dey look out for now, na how goment go handle di mata as political election season dey heat up across Nigeria.