Osinachi Nwachukwu: IGP tok wen dem go charge Osinachi's husband, Peter Nwachukwu to court over singer's death

Wia dis foto come from, Peter Nwachukwu/Facebook
Nigeria police don tok wen dem go charge late Osinachi husband to court.
Inspector-General of Police, Usman Alkali Baba na im announce dis on Wednesday 20th April, 2022 during di visit of di Minister of Women Affairs, Dame Pauline Kedem Tallen to im office.
Oga Alkali say considering di sensitive nature of di case, and di need to get justice, and quickly, di command don approach di National Hospital, Abuja, for post-mortem examinations on di deceased to know di cause of death and dem go charge her husband to court as soon as dem find out say e dey responsible for her death.
Also during di visit, di Minister discuss amongst oda tins di plight of women inside Nigeria, particularly in relation to gender and domestic-based violence.
She point out di recent case of di famous gospel musician, Osinachi Nwachukwu, wey her untimely death allegedly for di hands of her husband on 8th April, 2022 don cause public outcry.
Some members of di late singer family wey follow di Minister go dis visit, dey interested to know di effort police don put in place to make sure say swift justice happun for dis mata.
As di Inspector-General of Police, dey react, e note say di untimely death dey heart-breaking particularly as information from sources close to di family and independent witnesses finger her husband, Peter Nwachukwu, as pesin wey dey allegedly responsible for her death.
E tok say di FCT Command of di Nigeria Police Force, wey dey under di jurisdiction wia di incident happun, arrest di husband of late Osinachi for about 5pm on Sunday 10th April, 2022 for dia residence inside Lugbe, Abuja.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di suspect currently dey for detention for di FCT Police Command even as investigations still dey go on.
Oga for Police stress say di alleged act dey condemnable for all ramifications as e dey both illegal and immoral for one human to take di life of anoda in any manner contrary to di provisions of di aw.
E come also re-state di commitment of di Force under im leadership to make sure say cases of dis nature including domestic violence, sexual and gender-based violence, rape, and oda social vices, dem go give am di utmost attention with plan to bring dia perpetrators to justice according to di provisions of extant laws.
How police take enta di mata of late Osinachi Nwachukwu
Report bin come out on Friday 8 April, 2022 say Osinachi Nwachukwu don die.
Fans of di gospel music wey dey shocked to hear di news come begin send tributes for social media to mourn her death.
Odas wey dey close to di singer come begin point accusing finger of domestic violence give di later singer husband, Peter Nwachukwu.
Then for 11 April, 2022, Nigeria Police come confam say dem don arrest Peter Nwachukwu ova di death of im wife.
FCT Police tok tok pesin DSP Josephine Adeh confam di arrest to BBC Pidgin.
After which more family members of late Osinachi, like her mama and twin sister come begin speak out on things wey dem notice say di husband bin dey allegedly do to di late singer.
Wetin to sabi about Osinachi Nwachukwu

Wia dis foto come from, Osinachi Nwachukwu
Di singer wey dey in her forties die on Friday for Abuja.
Before her death, Osinachi na singer, songwriter wey become very popular for her song Ekwueme wey be collaboration she do wit singer Prospa Ochimana.
Di hit gospel song get ova 71 million views for Youtube.
Osinachi don feature for songs like Nara Ekele by Pastor Paul Enenche and Ema You no dey use me play and also release new song wey she title God of all power.
She usually dey sing in di Igbo language wey people from Nigeria southeast dey speak.
Osinachi leave behind her husband and her four children.
Since her passing, many fans of gospel music dey send tributes as dem dey mourn Osinachi Nwachukwu.












