Abuja-Kaduna train attack: Buhari don call di pipo wey carry out di attack 'terrorists'

Wia dis foto come from, Other/ Kaduna State
Nigeria President Muhammadu Buhari don tok say e dey pained ova di second attack on di Abuja-Kaduna train.
E say "our thoughts dey with di family of di pipo wey die and our prayers dey with those wey injure".
Buhari tok dis one afta meeting with Security Chiefs for Abuja.
Di Abuja-Kaduna train attack on Monday, 28 March, leave eight pipo dead and 26 wit injury.
Dis na according to di Kaduna state Commissioner for di ministry of internal security and home affairs, Samuel Aruwan.
Di suspected bandits bin use explosives for di track wey force di train to stop.
Afta di train stop, gunmen bin surround di carriages and start to dey shoot na wetin one of di passengers tell BBC.
Oga Aruwan say, according to train documents, na 362 pipo bin enta di train according to di recognised turnstile.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Investigations still dey go on to know which passengers bin dey di train wey dey unaccounted for at di time of dis update".

Wia dis foto come from, Other
But e no take into account di number of NRC staff and security officials wey bin dey di train.
Different reports dey circulate for di media say di numba of passengers fit plenti pass wetin dem dey count, so di goment dey try find out di exact number.
Meanwhile, di Nigerian Minister of Transportation Rotimi Amaechi don blame di lack of security solutions due to di process wey im say bin dey very slow for di incident.
E say if di process bin dey shortened, dem for don save lives.
Before di latest attack, many pipo bin dey tink as di safest way to go between Abuja and Kaduna, na by di train.
Abuja-Kaduna rail bin dey safer than roads

Kidnapping for ransom don become common for Nigeria.
Di Abuja-Kaduna highway na one of di most dangerous roads for Nigeria, sake of say kidnappers dey attack vehicles for di expressway and di road sef no good.
Dis don make many pipo abandon di road to go by rail wey dem bin open for 2016. Di train dey more expensive but pipo see am say na im safe pass sake of di trains dey get armed guards inside.
Dis go be di second time, di rail line between dis two cities go dey attacked in di last six months but di latest attack on Monday na di baddest one.
Wetin dey happun to find passengers

Wia dis foto come from, Nigeria Goment
So far, di Nigeria President don order di conclusion of di process to get and install di Integrated Security Surveillance and Monitoring (ISSM) for di Abuja-Kaduna rail line and make dem extend am to di Lagos-Ibadan rail line.
E also order di rescue of di kidnapped passengers as well as manhunt for di terrorists wey commit di attack.
E call for di Nigerian Railway Corporation (NRC) management to fix di rail lines wey damage for di attack so dat normal service fit start sharparly.
For now di NRC don close operations for di route.

Di govnor of Kaduna state, Nasir El-Rufai condemn di attack, wey im call "terrorist attack" and e tok sorry to di families of di victims. E follow tok say im goment go ffot di medical bill of pipo wey dem carry go hospital.
Di Kaduna authorities say dem dey collabo with di NRC to find out wia all di passengers dey and who dey miss.
Armed gangs still dey kill and kidnap pipo for money, especially for di Northern part of Nigeria even afta military operations on dia hideouts.
Last Saturday, dem attack di Kaduna International airport.












