Buhari in Zamfara: President Buhari make u-turn on plan to visit Zamfara

Wia dis foto come from, FEMI ADESINA/FACEBOOK
Zamfara govnor Bello Matawalle say president Buhari no go visit di state as schedule because of poor weather.
Di Nigeria president bin plan to visit di state on Thursday to condole with di pipo over recent attacks for Anka and Bukkuyum local goment areas wey leave over 50 pipo dead.
Di govnor say e speak to di presido and e assure am say e go put new date very soon for di visit.
"President Buhari bin dey come Zamfara today but as God plan am di weather no dey favourable for flying so na wetin stop di trip."
"I speak to di president and e assure me say e go fix new date for di trip."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Many states for northern Nigeria wake up with hazy weather condition on Thursday.
Di state bin don put plans in place to welcome President Buhari but now im don return to Abuja afta im bin go commission on cement project for Sokoto State.
Wetin Buhari visit to Zamfara bin plan to do
Zamfara state goment say di presido bin plan to come condole with dem over recent bandits attack for Anka and Bukkuyum local goment areas.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ibrahim speak to BBC about di president visit say dem bin don finish all preparations to receive am.
"So di visit no be only about condoling with di state goment over di attacks for Anka and Bukkuyum but President Buhari go meet di affected families directly to sympathise with dem too."
"We dey also expect am to visit di ongoing military operations wey dey happun here to ginger di officers to continue to dey bring out beta results in di fight against bad elements."
Na 58 pipo die for Anka, Bukkuyum attacks.
Na on di 4th of January of dis year bandits attack Anka and Bukkuyum local goment areas of Zamfara while some say na nearly 100 die, goment sources say na 58 pipo lose dia lives for di attacks.
Di bandits burn down four villages across di two LGAs killing 36 pipo in Anka and 22 pipo for Bukkuyum including vigilante pipo wey try to stop di attacks.
Some Nigerian soldiers also die for dis unfortunate attack.
'Di visit fit calm nerves'

Wia dis foto come from, GoV. BELLO MATTAWALE/FACEBOOK
Over di years one of di major complains of many pipo across northern Nigeria na say President Buhari no dey too visit areas affected by tragic happunings.
Just recently many pipo comot to protest for wetin dem call lack of sympathy from di presido as e no visit Sokoto state afta gunmen burn 42 passengers inside dia vehicle as dem dey travel.
Sani Shehu na social commentator and e tell BBC Pidgin say di visit to Zamfara to condole with families in Anka and Bukkuyum na good one from di presido.
"Given all di attacks wey don happun for northern Nigeria we know say e dey impossible for President Buhari to visit all but wen major one happun we expect am to not only send condolences but visit di place."
"So dis visit to Anka and Bukkuyum na positive one and na sometin wey di president suppose dey do since."













