Samuel Aboagye: Meet de 17-year-old wey dey build electric bikes to epp pipo wey dey live with disability

For dis interview, BBC Pidgin siddon with 17-year-old Samuel Aboagye from Tema, Ghana.

Im dey use im love for Science to build electric bikes and tricycle to epp pipo wey dey live with disability.

Aboagye dey try make life beta for pipo wey dey live wit disability with en electronic motorbike.

E hope to build free electric cars for dem too one day.

Video by: Favour Nunoo and Gift Ufuoma.