King of Satan death: Simon Odo wey be native doctor die at di age of 7

Eze Ekwensu

Expensive motor na im escort di deadi body of Simon Odo alias 'King of Satan' back to mother earth.

Although dem neva do di final burial of King of Satan according to custom and tradition, im family burial for night of di same day we im die.

Dem bury Simon wit very expensive motor wey dem first put inside ground before dem put im coffin on top.

As dem dey bury am, di car engine dey on and Simon favourite song dey play from di car stereo.

According to im son Uchenna Odo, na so im papa say make dem take bury am.

Simon Odo, wey pipo sabi as 'King of Satan' die at di age of 74, 14, December, 2021.

Im daughter Uchenna Odo tell BBC Igbo say her papa die around 3am on Tuesday afta short sickness.

Who be 'king of satan'?

Di late Odo bin tell BBC Igbo for one earlier interview say e marry 57 wives but im no know exactly how many pikin im and im wives born.

Im na very popular native doctor wey dem sabi as King of Satan.

Simon Odo na from Aji for Igbo-Eze north local goment area for Enugu state.

Inside interview wey Simon do wit BBC Igbo before in die, im say: "I be real king of Satan. If you slap me I slap you."

E say wetin im dey do na from im mama place e from come.

Oga Odo no bin dey into juju worship all im life. Dem born am as Catholic.

"Dem baptise me for 1956, I do confirmation for 1958, serve mass from 1959 reach 1960. true tok na im I dey tell you," im tok.

Wetin make am turn native doctor?

For five years im bin suffer tuberculosis wey im believe say na do dem do am.

Afta dat one, im fall sick again. "From dat tuberculosis of five years dem come do me jazz, I come cripple for five years," e add.

All dis sick-sick make Simon land Ijebu Ode, im say na dia im find out say na pesin do am, say no be God dey suffer am.

Im stay for Ijebu Ode land for seven years learn work before im return to im home begin treat pipo.

Simon say im powers no be for killing pipo. E say "if pesin bring three hundred million dollars say make I kee pesin for am, make I give am poison, I go tell dem na over my dead body. Di day I go do am, I go die."