Sanusi Lamido: Court reverse Sanusi banishment from Kano say e dey against di law

Sanusi and Ganduje

Wia dis foto come from, Other

Federal High Court for Abuja, Nigeria don declare as unlawful and violation of im fundamental human rights, wetin hapun afta dem dethrone di Emir of Kano, Sanusi Lamido Sanusi, wen dem banish am from Kano, and use force relocate am to Awe, for Nasarawa state.

For her judgement, Justice Anwuli Chikere say di manner by which security operatives use force take remove Sanusi from di palace for March 2020 afta im dethronement on di order of di Kano State goment to Nasarawa State against im will na serious violation of im rights to personal liberty and freedom of movement.

Di judge wey also declare say the Emirate Council Law 2019 under which di Kano State goment claim say dem act no follow, also add say as citizen of Nigeria wey no commit any offence, Sanusi dey entitled to live for any part of di kontri.

Justice Chikere award N10 million damages against di Kano State Goment, di Inspector General of Police and di Department of State Services and order dem to tell Sanusi sorry for at least two national newspapers.

How di mata hapun

For 2019 di relationship between Govnor Abdullahi Ganduje and di former Central Bank govnor wey turnEmir no too dey bam. Tori be say some pipo wey dey goment feel say di Emir no support dem for elections wey hapun dat year.

Di state goment later say dem receive letter from one join bodi of 35 civil society wey ask dem to begin shaparly di process to comot from office, di Emir of Kano, Muhammadu Sanusi di second.According to di statement wey di tok-tok pesin to Govnor Ganduje sign, di joinbodi say dis na to protect di rule of law and mandate wey Kano pipo give di govnor.

As dat mata bin dey ground, di govnor propose bill to create four emirs to dey share Kano emirate with Sanusi. Di four new emirs get same power as Sanusi. Di action reduce Sanusi power, wey be say 44 councils wey dey under im control before come reduce to only eight.

Wetin we call dis Video, Sanusi Lamido: King come, king go, Kano remain

Small time afta dem don cut im power, di Kano Public Complaints Anticorruption Commission start to dey investigate di emir on top financial misconduct for di second time.

Di emir try fight back and im come go get order from Magistrate court for Kano wey command di Anticorruption Commission make dem stop to dey investigate di emir.

Anoda gbege start wen di State Assembly form eight-man committee to investigate di emir again.

Di state assembly tok say dem collect two petitions wey accuse di emir say im no dey obey law and tradition.

Na report from dis petitions come lead to Sanusi dethronement on Monday, March 9, 2020.

Di Kano state Executive council remove Emir Sanusi from power and banish am to Nasarawa state wia e dey for sometime.

Dem claim say di Emir of Kano totally disrespect lawful instruction from di office of di state govnor and oda lawful authorities.

Dem add say di decision to remove di Emir na to secure di culture, tradition, religion and prestige of di pipo of kano state.