Baba Suwe burial: Nollywood celebrities wey attend Baba Suwe burial in pictures

Nollywood actors gada for di burial of Babatunde Omidina popularly known as Baba Suwe for Lagos on Thursday.
Baba Suwe die for di age of 63 afta small sickness, according to wetin im son confam to BBC Pidgin.
Sola Omidina, say di Nigerian comedian die around afternoon on Monday, 22, November, 2021
Di burial of di late actor and comedian hapun for im house for Ikorodu, Lagos state, south west Nigeria.
Nollywood actors gada for im house to pay dia last respect.











Who be Baba Suwe?
Dem born Babatunde Omidina aka Baba Suwe on August 22, 1958, for Inabere Street for Lagos Island.
But di legendary actor come from Ikorodu local goment area of Lagos.
E marry e wife, Omoladun Omidina wey also be actor for 1995 and she die for September, 2009.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di popular actor bin attend Jamaitul Islamial Primary School for Lagos, and Children Boarding School, Osogbo.
After im boarding school, Baba Suwe bin get im West African School Certificate for Ifeoluwa Grammar School for Osogbo, Osun State, southwest Nigeria.
Baba Suwe begin acting career for 1971 and e bin act for both English and Yoruba language films.
Di veteran Nollywood comedian dey often play di role of confuse servant or security guard.
E become popular afta e feature in one movie titled, Omolasan.
Im become more popular afta e act for Iru Esin wey Olaiya Igwe produce for 1997.

Wia dis foto come from, @BABASUWETV
Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin arrest Baba Suwe afta dem accuse am of trafficking cocaine for 2011.
As di agency put am for custody sake of say dem want make e excrete di cocaine wey dem suspect say e dey im stomach, nothing come out of Baba Suwe belle.
Di agency chop blame ontop di case and court come judge say make dem pay Baba Suwe more than $155,000 as compensation and apologise to am.














