WAEC result 2021 latest: WAEC seize many candidates results, see how to check 2021 result

Wia dis foto come from, Getty Images
WAEC use 45 days release di West African Senior Secondary Certificate Examination for year 2021.
But results of 170,146 candidates, wey be 10.9% of di total number of candidates wey write di exam wey end for October 8, 2021 still dey wit di exam bodi.
Dis mean say thousands of candidates no go fit see dia own now sake of WAEC don seize am.
According to di statement wey West African Examination Council release, dem sieze dis 2021 results sake of say e connect wit case of exam malpractice.
Dis WAEC WASSCE Exams start August 16 and end October 8, 2021.
WAEC say di tin wey dey worry dem be activities of rogue-website operators and some oda social media platforms.
Dis na those wey dey post exam questions online immediately afta di di paper dey administered, WAEC explain for statement.
Dem also complain of pipo wey dey use phone for exam hall despite say e dey banned.
End of Di one wey oda users dey read well well
WAEC add say some schools dey arrange organized cheating, plus oda big matter.
Di exam bodi say dem dey investigate all di case and reports of di investigations go dey presented to di right Committee of di Council to reason am kia kia.
Di Committee decision go dey communicated to di affected candidates through dia schools.
How to check your WAEC result
Candidates wey sit for di August to October 2021 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) no go need buy scratch card or pin to check dia result wen e come out.
West African Examination Council (WAEC) Head of Public Affairs, Demianus Ojijeogu na im give dis informate to BBC Pidgin.
Wetin candidates go need do na to check di Smart Identity Card wey dem use during di examination for dia Result Checker PIN and Serial Number.
Read on to sabi "how to check WAEC result 2021"
WAEC Results: How to check online
1. Log enta di WAEC result checking portal, www.waecdirect.com
2. Enta your 10-digit WAEC Examination Number - (Dis exam number include your 7-Digit centre number and your 3-digit candidate number eg. 4123456789)
3. Enta di 4 digits of your Examination Year eg. 2002
4. Select di Type of Examination
5. Enta di e-PIN Voucher Number
6. Enta di Personal Identification Number (PIN) on your e-PIN
7. Click submit and wait for di results window to come up.
Certificates of candidates wey dem don already process and release dia result go ready within di next 90 days, counting from today, na so WAEC tok.

Wia dis foto come from, Official WAEC
How many candidates bin register and how many siddon write exam?
According to WAEC, 1,573,849 candidates bin register for di exam from 19,425 secondary schools wey gomment sabi for di kontri.
1,560,261 candidates bin siddon write di exam.
Some candidates from some schools from Benin Republic and Cote d'Ivoire, wia Nigeria curriculum for Senior Secondary School dey use also follow write di exam.
Schools for Equatorial Guinea no present candidates for di exam sake of COVID-19 wahala, WAEC add.
Di statement also tok say Analysis of di statistics of how candidates perform for di exam show say, out of 1,560,261 candidates wey write di exam,
1,398,370 candidates, wey be 89.62%, gbab credit and above for minimum of any five subjects.
Dis one mean say e fit be wit or without English Language and Mathematics or one of di two ogbonge subjects.
1,274,784 candidates, wey be 81.7%, gbab credits and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics.

Wia dis foto come from, Getty Images
See summary of di 2021 WAEC result
WAEC say out of di number wey register for di exam, 1,560,261 candidates siddon to write di exam.
Out of di total number of candidates wey sit for di exam for Nigeria, WAEC say dem don already process and release di result of 1,256,990 candidates, wey represent 80.56% of all di candidates.
Also, WAEC still dey process di results of 303,271 candidate wey represent 19.44% of candidates. Reason na sake of say di candidates get some issues wit dia subjects.
1,560,261 candidates na im get credit and above for a minimum of any five subjects wit or witout English Language plus Mathematics.
1,274,784 candidates get credits and above for a minimum of five subjects, plus English Language and Mathematics.
WAEC say dem seize di results of 170,146 candidates wey get hand for different kain reported cases of exam mago-mago.
Out of di (1,560,261 candidates wey sit for di exam, 784,677 na males, 775,584 na females, wey represent 50.29% and 49.71%, respectively.
Dia report also show say na total of 1,539 candidates, wey get different kain degree of Special Needs, na im register for di exam.
Out of dis number, 460 get eye challenges, 582 get hearing problems;
362 dey mentally challenged and 59 dey physically challenged.
WAEC say di Result Checker PIN and Serial Number wey candidates need to check dia results online don already dey di Candidate Smart Identity Card wey dem use wen dem dey write di exam.
Women no carry last for dis year WAEC
630,138 wey be 49.43% be male candidates.
644,646) wey be 50.57% be female candidates.
Di exam join bodi say di percentage of candidates wey dey dis category for WASSCE for School Candidates, 2020.
Dis mean say di pipo wey gbab credit and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics, be 65.24%. Dis one na appreciable 16.46% improvement for performance.













