Federal University of Dutse SUG president pictures with bodyguards and car - School authorities reveal real tori behind viral fotos

Wia dis foto come from, Other
Federal University of Dutse wey dey northern Nigeria don comot to deny say di student union president of di school dey live large afta fotos begin trend for social media wey show am with Mercedez Benz and security.
Some blogs bin report say dat na how Mukhtar Umar wey be di SUG presido dey enter class each day given im position for di school.
According to di university, di fotos na from wen students of Criminology department dey do one course wey wan teach dem how to protect high profile personality.
Di school add say e no dey possible for a large number of students to abandon dia lectures just to escort SUG president.
"Di university dey take teaching students both in learning and character seriously and no go allow dat kain behaviour for campus." Dat na wetin part of di statement read.
BBC Pidgin also reach out to Staff and students from Federal University Dutse on di mata and dem also deny wetin many for social media and blogs dey yan.
One staff tell BBC Pidgin say dat tori na fake news as na one time tin wey happun on Matriculation day for new students last week.

Wia dis foto come from, Rano Isah
Prince Ahmad Amoeva na student parliamentarian and friend of di SUG president and e tok say di SUG presido no even dey attend classes at di moment as e dey do im SIWES (work training) for Abuja.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Blogs just dey lie on dis issue, we hold Matric for school last week and di pictures na from di event, di security wey dey with am na students from sociology department wey dey run experiment and di car na school get am, Mukhtar (SUG presido) na normal student like all of us." E tok.
Wetin di SUG presido tok?
SUG president for Federal University Dutse tell BBC Pidgin say e pain am di way pipo just dey use im pishures dey lie for blogs and social media.
Mukhtar Umar say e dey important for pipo to dey confam things before dem post or write anything.
"As di school explain na so e be, I no be pesin wey like to show off or do things like dat. Di pictures na from a single event and di security na students of criminology wey dey carry out experiment." E tok.
Some tins you gatz know about di Federal University Dutse
Di University dey among nine universities wey Nigerian Federal Government establish for 2011 during di tenure of President Goodluck.
Di school dey offer both undergraduate and post graduate programmes and hold first convocation for 2016.
FUD get only one campus and na for Dutse di capital of Jigawa for northwestern Nigeria e dey.
FUD bin start with 205 students but after five sessions di university grow to over 3000 students wey dey study from di 17 departments and dem also establish college of medicine and health sciences after five years of existence.
Di school bin enter limelight earlier dis year when final year mathematics student Abdullahi Bello commit suicide on to say im girlfriend dey cheat on am.










