Chidinma Ojukwu plead not guilty to di murder of Super TV CEO Usifo Ataga

Chidinma for court

Chidinma Ojukwu don plead not guilty for di murder of Super TV CEO, Usifo Ataga.

Di 21-year-old University of Lagos undergraduate plead not guilty wen she appear for High Court for Lagos on Tuesday.

Miss Ojukwu togeda with one oda suspect Adebayo Quadri dey face eight count charge of murder, stealing and forgery among odas.

Mr Quadri also plead not guilty to di charges.

Her sister, Chioma Egbuchu wey dem also arraign don plea not guilty to receiving di late Mr Ataga Iphone 7.

Di trial proper go now begin for 9, November.

Di two defendants dey face eight count charges wey include conspiracy, murder, stabbing, forgery, stealing and say dem make bank statements. Na Lagos state goment dey sama dem di charges.

Di director of DPP Mrs Olayinka Adeyemi tell court say di defendants conspire among demsefs and allegedly murder di deceased on July 15 2021.

She say, di defendants allegedly kill Usifo Ataga by stabbing im plenti times wit knife for neck and chest, say di incident hapun for 19 Adewale Oshin street Lekki Phase 1, Lagos.

DPP add say dem also allegedly conspire to commit forgery of bank statements of di deceased for two banks and allegedly forge international passport and drivers license for Chidimma.

DPP also accuse Chidimma say she steal two iPhones, one Macbook, ATM cards of Usifo and withdraw 380,000 naira from di account.

Di offense dey punishable under sections 411, 233, 365 (2)b, 280, 329 of di criminal laws of Lagos state 2015.

Wetin else hapun for court today?

After di arraignment on Tuesday, prison wardens bin carri Chidimma and Quadri dey run away from journalists wey carri camera dey follow dem.

Chidimma wear face mask, carri hair scarf cover her head.

Dem hide her inside anoda court room for over one hour till plenti journalists leave before dem move her out of court into a waiting prison shuttle. Tori comot for June 2021 say Chidimma Ojukwu be suspect for di murder of Usifo Ataga afta dem find im deadi bodi inside one service apartment for Lekki area for Lagos.

Authorities later arrest Chidinma on 23 June for her papa house for Yaba, Lagos and parade her for police headquarters Ikeja.

Dem bury Usifo Ataga on 30, July for private burial wey family members and im wife attend.