Kano Torture House: Di tori of di 'rehabilitation centre' for Kano state wey Police rescue 47 men plus pikin wey dem chain hand and leg

Wia dis foto come from, Kano Police Command
Police for Kano state northern Nigeria on Thursday discover and rescue 47 inmates in chains for one torture house inside di city.
Dem find di victims wit plenti injuries because of torture before dem unchain dem and move dem go di Murtala Mohammed hospital for treatment.
Di discovery lead to arrest of one 35-year-old Aminu Rabiu and im brother 40-year-old Fatihu Rabiu wey dey run di centre illegally despite say Kano state goment ban all dis kain facilities 10 months ago.

Dis torture centres wey di owners dey call 'rehabilitation centres' don dey ground for many years before goment ban all of dem after dem observe say many bad bad tins dey happun dia.
How di house bin start
Imam Rabiu Yar Akwai start di centre wey dem name Madrasatul Fatahil Islam, 45- years-ago and di place wey dey less than 7km to Kano city centre bin start as ordinary Islamic school according to one of di teachers before dem expand.
"Before I begin teach here, I be dia neighbour for over 30 years. E start as normal Islamic school but overtime parents and relatives begin dey bring disturbed children for rehabilitation and na from dia e kontinu but till now, di islamic school still dey."
BBC News Pidgin tori pesin Mansur Abubakar visit di centre and e see place.

Di place dey scattered sake of di police raid, but some of di teachers say di place dey always neat.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Time table dey for all dia activities and we dey make sure say we treat dem right. Wetin police yan say all of dem dey chains no be true na only three pipo dem meet for chains, all di rest dey free - even dose 3 na bicos say dem fight teacher."
How di school be
About eight rooms dey inside di facility wey dey face each oda.
Parts of di ceilings don tear and di toilets no reach 4 for di centre wey get over 50 pipo as full time residents. Di teachers show generator wey dem dey use, if light no dey.

Wia dis foto come from, Kano Police
One of di teachers say unlike wetin police dey tok about how dem jampack di inmates, na less than eight pipo dey per room and di space dey enuf for dem.
Wetin dey happen for di rehabilitation centres?
Some pipo wey dey seek help for dia children or relatives from drug addiction or anoda bad behaviour dey carry dem go meet dis torture centres for helep.

Di methods wey di centres dey use dey against human rights and any form of decency.
'My broad bin dey improve'
Sabiu Yunusa bring im 19-year-old brother to di place over a year ago afta im suffer from addiction and according to am, e broad dey get beta plus e don don memorise plenty part of Quran sake of wetin dem dey do for di centre.

Im follow tok say e no dey happy about wetin police do.
"I see serious improvement for my broda because of dis centre and i dey sad say goment and police go do dis kain action, goment no get rehab centres and dis na our only choice."

Wia dis foto come from, Kano State Police
Sake of di kain abuse of human rights and methods dem dey use, many states across northern Nigeria don close dem down.
Neighbours complain to BBC News Pidgin about tear gas wey police use as dem reach di place on Thursday, 7 October.
But tok-tok pesin for Kano Police Command, DSP Abdullahi Haruna deny di accusation say dem use tear gas, say no single officer use am for di whole operation.

"Wetin pipo and neighbours tok about tear gas no be true as I follow go dat operation and we no use any tear gas for dia."
Di officer also yan say dem go soon charge di present owner of di centre Fatihu Rabiu wey be pikin of di late founder and im broad, Aminu Rabiu to court afta dem finish dia investigations













