Nnamdi Kanu: IPOB leader sue FG, demand five billion naira, apology for infringement of im human rights

"Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] 'Nnamdi Kanu extradition arrest' in Nigeria ', go appear for Nigeria court - 'Abubakar Malami'

Di leader of di Indigenous People of Biafra, Ipob, Nnamdi Kanu dey sue di federal goment of Nigeria to tune of N5000,000,000.00 (Five billion naira) and dey demand apology for di infringement of im fundamental human rights.

Dis one dey inside di order from one High Court for Abia state wey hear di mata on Tuesday, 7, September. 2021.

Di Ipob leader lawyer, Alloy Ejimako say dem bin serve exparte order for di court wey hear di mata for di first time on Tuesday and di court approve say make dem serve di respondents for di case, di application for enforcement of di Fundamental Rights of Mazi Nnamdi Kanu.

Di eight respondents dem join for di case include di Federal Republic of Nigeria, Attorney General of di Federation, Chief of Army Staff, Brigade Commander, 14 Brigade, Nigerian Army, Ohafia, Abia state, di Inspector General of Police, Commissioner of Police Abia state, Director General, State Security Services and di Abia state Director State Security Services.

According to di suit, Kanu want make court declare say di military invasion of im house for Isiama, Afaraukwu Ibeku, Abia State on 10th September, 2017 by di respondents or dia agents dey illegal, unlawful, unconstitutional and amount to infringement of im fundamental right to life.

Kanu also ask di court to declare say im arrest and torture for Kenya and subsequent detention for Nigeria by di respondents or dia agents without due process of law, dey illegal, unlawful, unconstitutional among oda tins.

Kanu also want di court to grant order wey go stop di respondents or dia agents from taking any further step to prosecute am. Im want di court to grant order to mandate im release from detention and restore am to im freedom as how e bin dey as of di 19th June, 2021; and to repatriate am to im kontri of domicile (Britain) to await di outcome of any formal request di respondents go file before di competent authorities for Britain for im lawful extradition to Nigeria to continue im prosecution in Charge No: FHC/ABJ/CR/383/2015 (Federal Republic of Nigeria v. Nnamdi Kanu).

E also ask make di court grant order for di respondents to issue official letter of apology to am, for di infringement of im fundamental rights; and publication of di letter of apology for inside three national dailies. Im dey also demand di sum of N5000,000,000.00 (Five Billion Naira) as monetary damages from di respondents jointly and severally for di physical, mental, emotional, psychological and oda damages im don suffer as a result of di infringement of im fundamental rights.

Di next hearing date dey set for 21st September, 2021 for Umuahia.

Wetin we call dis Video, Nnamdi Kanu explanation to im lawyer on how dem arrest am for Kenya

Di arrest of di Ipob leader bin don cause controversy for Nigeria.

Di Nigerian goment no gree reveal which kontri dem arrest Nnamadi Kanu from but di Attorney General of di Federation and Nigeria Minister of Justice, Abubakar Malami bin say na through plenti intelligence and cooperation wit Interpol and oda security for di kontri dem catch Mazi Nnamdi Kanu.

Malami say dem intercept and den return alias extradite Kanu come back Nigeria on Sunday, 27, June, 2021.