Ghana Police arrest Okada rider who allegedly behead 13 yr old for ritual in Volta Region

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana Police arrest 25 year old Okada rider, Dovi Tsidi for Volta Region who allegedly behead 13 year old boy for rituals.
Residents for Avehime claim say de young man allegedly kill de boy, cut off en head go give one prophetess for ritual money purpose according to residents.
But Police say dem no fit confirm de direct link to ritual money but so far dem arrest three people in connection to dis crime, while one dey at large.
Inspector Prince Dogbatse, Public Relations Officer for Volta Regional Police Command talk BBC Pidgin say:
"We deposit de body of de 13 year old for Bator Hospital Mortuary while dem continue to investigate circumstances leading to de murder".
"De incident happen for Avehime, Central Tongu district around 10.15pm" he talk BBC Pidgin Favour Nunoo.
He explain say Police receive information on Sunday say some murder happen, so upon reaching de scene dem discover de body of de 13 year old.
Police say dem still dey investigate de matter, meanwhile dem dey on manhunt for de fourth suspect who dey on de run.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ghana and recent murder cases
Ghana in recent past dey experience increasing cases of murder, most of de victims be children.
Last week, police arrest one young man for Abesim near Sunyani after he kill three kids put some of dema parts inside fridge for en house.
Only dis year, de murder of 12 year old boy for Kasoa by two teenage boys for money rituals shock de entire country.
In 2018, de kidnappings three Takoradi girls who police later discover say dem die disturb Ghanaians over de level of insecurity especially for kids.
Safety and security start dey turn major issue for de West African state which until recent past enjoy peace and security within de subregion.











