Latest election results in Zambia: Electoral Commission update na say Hakainde Hichilema dey in early lead

Wia dis foto come from, Getty Images
Early results from Zambia presidential election show say na di opposition candidate, Hakainde Hichilema, dey lead over di incumbent Edgar Lungu, according to di first results from di electoral commission early on Saturday.
Consolidated Results for 62 out of 156 Constituencies show say Incumbent President Edgar Lungu get: 562,523 while Hakainde Hichilema get: 1,024,212.
Di electoral commission go announce more result later on Sunday.
Some of di constituencies where oga Hichilema perform well na where dem consider to be strongholds of di incumbent, Edgar Lungu.
Dis suggest say Hichilema don gain ground since di last elections for 2016, wen e lost by slim margin for di contested elections wey allegations of rigging dey.
Total of 296,210 votes na im dem cast for those constituencies, representing 71.75% turnout rate, chief electoral officer Patrick Nshindano tell media briefing for di capital Lusaka.
Dem initially dey expect di first result on Friday, but delay come dey afta counting continue overnight sake of di plenti number of voters wey turnout and because political parties no gree for electoral commission first figures for one constituency, wey different with those from monitors on di ground.
Di Electoral Commission of Zambia allow di last polling station to remain open until 5 a.m. (0300 GMT) on Friday to give pipo wey don already stand for queue opportunity to cast dia votes even with di
End of Di one wey oda users dey read well well
restrictions on internet access and violence for three regions.
Estimated of 7 million pipo na im register to vote for di presidential and parliamentary elections wey di two main contender na Hakainde Hichilema and President Edgar Lungu.
Oga Hichilema, na successful businessman and challenger, Edgar Lungu dey try to win second five-year term in office.
How di election be?

Wia dis foto come from, Getty Images
Voting begin for Zambia general elections early on Thursday morning, with long queues for some polling stations.
President Edgar Lungu, dey among di first pipo to vote as polls open for di capital Lusaka. 14 oda presidential candidates na im dey for di race.
"We dey win, otherwise I for no dey for di race if we no dey win," President Lungu tell journalists afta voting, E add say Zambians "come in to vote in numbers".
Meanwhile, di kontri election commission bring out list of instructions for voters inside Zambia general election wey include ban on women painting dia nails.
BBC tori pesin for Lusaka, Nomsa Maseko, tweet list of Do's and Don'ts wey include si words: "No painted nails (for ladies)."
As e be say dem go mark voters thumb with one special ink once dey cast dia vote.
Di election referee believe say pipo fit also use acetone wey dem dey use remove nail polish take comot di special ink, Nomsa tok.
Report also come out from internet monitoring service, Netblocks say mobile phone social media and messaging apps no work for Zambia during di day of di election.
Access to WhatsApp restricted, Twitter and Facebook dey block and pipo begin virtual private networks -- known as VPNs -- to bypass local restrictions.

Wia dis foto come from, Twittter
Zambia main opposition candidate Hakainde Hichilema later come call for restoration of internet afta Thursday elections.
Then on Friday, High Court for Lusaka order internet access to be fully restore afta some social media sites bin dey blocked.
Di Election day pass peacefuly, but President Edgar Lungu, claim say violence happun for North Western province of di kontri.
Who be Hakainde Hichilema

Wia dis foto come from, Getty Images
Hakainde Hichilema wey also dey known as HH, na self-made millionaire businessman, wey be di youthful and energetic leader of di major opposition political party for Zambia- di United Party for National Development (UPND).
Dem born Hichilema for June 4 1962 for di southern district of Monze.
Afta e attend school locally e get admission to University of Zambia on goment bursary where e study and graduate for 1986 with Bachelor of Arts (BA) in Economics and Business Administration.
Hichilema Alias HH later get MBA degree in Finance and Business Strategy from di University of Birmingham, UK.
Since then Hichilema don create strong track record for business, both for im kontri and internationally. E be commercial famer and now get di second biggest cattle rancher for Zambia with nearly 100,000 herds of cattle for four ranches.
Hichilema na also one of di biggest suppliers of meat to di local Zambian market plus one of Zambia biggest exporter of hard-currency-earning beef products. E also get investment for Zambia tourism sector.
Oga Hichilema win di presidency of di UPND for 2006 afta di death of di leader, Anderson Mazoka, wey be im business mentor, tribesman and close friend.
E don tey wey Hichilema dey contest to be president, e run for 2006, 2008, 2011, 2015 and 2016 Zambia election.
For di January 2015 president by-election, Hichilema come second for di race falling short by just 27,000 votes (1%).
Dis 2021 presidential election mark oga Hichilema sixth attempt to secure di presidency.
Follow us for more tori on who go win between Edgar Lungu and Hakainde Hichilema













