Lagos state local government election: No movement in Lagos today and oda tins you need to know about di LG election in Ogun state and di commercial city

Low turn-out lead to late start of di local goment elections for some polling stations wey BBC Pidgin visit on Saturday, 24, July, 2021 for Lagos state south west Nigeria.
Dis na as Lagos and Ogun states dey vote for new chairmen and councillors into local government areas and council development areas.
Seven hours movement restrictions dey for Lagos state, sake of local government elections.
Di Lagos State goment announce movement restrictions throughout di state from 8:00 am to 3:00 pm on Saturday, July 24, 2021.Na Lagos State Independent Electoral Commission (LASIEC) go conduct di elections for all 20 Local Government Areas (LGAs) and 37 Local Council Development Areas (LCDAs) inside Lagos.
Commissioner for Information and Strategy Gbenga Omotosho for inside statement say:
" Di restriction na to enable di Lagos State Independent Electoral Commission (LASIEC) conduct hitch-free elections into positions of Chairmen and Councillors in all di 57 Local Governments and Local Council Development Areas."
Oga Omotosho say di restriction go allow easy movement for pipo wey go vote, election materials and LASIEC officials for di sake of di election, effective monitoring and ogbonge security.
E advise all di pipo wey fit vote to participate in di elections, wey require di cooperation of all residents.
End of Di one wey oda users dey read well well

For Ogun State, 12 political go battle for council chairmanship or councillorship for di 236 wards inside di 20 local government areas of di state.
Ogun State goment too announce state-wide restriction of movement on Saturday to allow for a smooth and peaceful conduct of local government elections.
Commissioner for Information and Strategy in Ogun state Abdulwaheed Odusile tok for statement say di nine-hour restriction go be between 7 a.m. and 4 pm.
Di statement add say voters go fit move to dia polling centres within dia neighbourhood and cast dia votes for di candidates of dia choice.
Authorities also deploy additional 25,000 policemen for Lagos State to beef up security.

Wetin to know about di local government elections
Di local goment election na to elect chairmen and councillors into di local government areas.
Di elections na di grassroots election wia residents of one area get opportunity to choose dia councillors and chairmen wey go represent dem at di local goment level.
For Lagos, anybody wey don reach 25 years of age fit contest for councillor and 30 years old fit contest for chairman position.
Na state electoral officers dey conduct di election.
Na fourteen political parties go participate for dis year local government elections for Lagos inside 20 local goment areas and 37 local council development area, LCDA.
Di parties be:
ACCORD
ACTION ALLIANCE
ADP
AAC
APC
APGA
APM
BOOT
LABOUR
NRM
NNPP
PDP
SDP
YPP.
How di restriction of movement go affect you
Everibodi wey dey live for Lagos and Ogun states dey expected to stay for dia house tomorrow so dat pipo wey wan vote go fit vote.
For Ogun state, di restriction of movement na between 7:00am- 4:00pm.
Di only pipo wey go fit move about during di seven hours restriction time for Lagos state, between 8:00am to 3:00pm na, Lasiec officials, press, medical personnel and oda essential workers.
More fotos from di election for Lagos














