Nnamdi Kanu: Ipob lawyer visit Biafra activist for Nigerian detention centre for first time
Lawyer to Nnamdi Kanu di leader of di pro-Biafra group, IPOB, say e don speak to di activist for di first time from detention.
Di lawyer say Kanu tell am say dem arrest am for Kenya and bring am back to Nigeria about three weeks ago to face treason charges.
Nnamdi Kanu lawyer Alloy Ejimako tell BBC say:
Dem allow am to see im client wey dey di custody of Nigerian secret police, for di first time since dem bring am back into di kontri to face trial.
"Di separatist leader no look well e get bruises for im hand and di back of im head". Alloy tok
!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] [Which country was Nnamdi Kanu arrested?] 'Ipob leader/Biafra separatist extradition trial'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/B92C/production/_119140474_nnamdikanuarrestinnigeriaipob'nnamdikanudeyarrested'hownigeriansreact.png.webp)
According to Kanu lawyer, e say im client say dem keep am for one private facility for Kenya and chain am to bare floor for several days.
Him claim say dem beat and torture and keep incommunicado before dem hand ova to Nigerian authorities.

Wia dis foto come from, Reuters
But Nigerian goment neva react to dis claims.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nnamdi Kanu and im lPOB na proscribed group by Nigerian goment sake of say dem dey ginger for separate nation from Nigeria as an independent state of Biafra.
Nigeria goment say dem arrest Nnamdi Kanu on Sunday, 27 June, 2021.
Kanu dey face treason charges and suppose appear for court on July 26th.






!["Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] Ipob leader get "Umaru Dikko" treat?: What next for di 'Biafra separatist'](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/A8A7/production/_119157134_nnamdikanuarrestedtoday-ipobnewsipobleadergetumarudikkotreatwhatnextfordi'biafraseparatist'.jpg.webp)









