Southern governors meeting: Sanwo-Olu, Wike, Akeredolu, odas say make next Nigeria president come from south

Govnor Rotimi Akeredolu

Wia dis foto come from, Govnor Rotimi Akeredolu

Southern Govnors for Nigeria don take stand say make di next president of di kontri come from di south.

Dem agree dis one for di meeting of di southern govnors wey happun for Lagos state.

Di Southern Governors Forum end for Lagos with firm position for rotational presidency between di North and South in di next Presidential election for Nigeria.

Di Chairman of di Forum and Governor of Ondo State, Mr. Rotimi Akeredolu, wey brief newsmen afta di meeting say, na joint decision for di meeting say make next President of di kontri come from di south.

Di meeting dey come few months afta di one wey bin happun for Asaba wey Delta state Governor bin host.

For dia, di governors agree to ban open grazing, call for restructuring of Nigeria, and di need for state police.

Dis time, host govnor Lagos State, Babajide Sanwo-Olu receive di govnors for Alausa, Ikeja, di venue of their meeting before dem proceed for dia closed door meeting.

Some of di pipo for di meeting na Govnor Rotimi Akeredolu of Ondo State; Governor Nyesom Wike of Rivers State; Gboyega Oyetola of Osun State; and Edo State deputy governor Philip Shaibu.

Odas na Ogun State Govnor Dapo Abiodun; Enugu State govnor Ifeanyi Ugwuanyi; Ekiti State Govnor Kayode Fayemi.

Oluwarotimi Akeredolu

Wia dis foto come from, Oluwarotimi Akeredolu

Di conclusion of di meeting wey di Southern Governors Forum (SGF) do for Lagos highlight 6 areas, from wia di next president suppose come from and di security situation for Nigeria.

Key tins from di 5 July meeting:

Next President - SGF say dem agree say make Nigeria presidency dey based on rotation between di north and south part, and therefore di next president, come 2023, suppose be from di south.

Dis na because di current president, Muhammadu Buhari wey dey serve im second 4-year term, come from northern Nigeria.

Security - On mata of security, di joinbodi give support for di forming of State Police, against di federal police system wey Nigeria dey use.

Govnor Rotimi Akeredolu

Wia dis foto come from, Govnor Rotimi Akeredolu

Cattle grazing - And by Wednesday, 1 September, 2021, SGF say di anti open grazing law suppose don take effect in all dia member states.

Open grazing, wia herders fit lead dia cattle to chop anywia dem see food, don cause many deadly clashes between farmers and di cattle owners all over Nigeria.

Di anti-open grazing law mean say cattle headers go only stay for areas wia goment don mark for dem to dey.

Petroleum Industry Bill (PIB) Law - Di joinbodi say dem reject di proposed 3% support money wey communities wey get oil go collect. Instead dem want am to be 5% of di revenue di oil generate.

Dem also reject di proposed 30% share of profit for di exploration of oil and gas inside di Basins.

Elections - SGF believe say how di electoral act no get compulsory electronic transmission of result inside, dey take democracy backward.