Muhammadu Buhari: Nigeria President say 'our problem no be ethnicity but ourselves’

Wia dis foto come from, Muhammadu Buhari
President Muhammadu Buhari say ethnicity and religion no dey responsible for di injustice for Nigeria.
Buhari say "na we ourselves be di problem."
Na wen some of im political support group visit Buhari for Abuja n aim di Nigerian leader tok dis one.
E say for several years wen e dey contest for election dey lose, say those wey di rule against an for court na pipo from in own area wey be Muslim like am.
Meanwhile Christians dem dey support am, di Nigerian leader yan.
Di President wey give detail narration on top all im court wahala and how dem throw im case away, say:
For 2003, im don spend 30 months for court and den na im class mate for school, Justice Umaru Abdullahi and Chief Mike Ahamba wey be Roman Catholic and Igbo man na im fight im case.
Sotey e reach Supreme Court and for dia, a Fulani man like am na im dismiss im case. Buhari explain.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di president say for 2007, one Justice Kutigi, a Muslim like am from Jigawa state troway I'm case.
And for 2011, Buhari say di mata no change as anoda Fulani pesinn by name Justice Musdafa dismiss im case.
Di President say im mention all dis one to show say no be ethnicity or religion be dey biggest problem for di kontri but Nigerians demselves.
E say over di years dem no fit accuse am of corruption and I don hold different position for di kontri.
I don be govnor, Minister of Petroleum Resources, Head of State, and president for second term.










