Jacob Zuma sentence latest - How Duduzile Zuma respond afta South Africa court find her papa guilty of contempt

Jacob Zuma

Wia dis foto come from, AFP

Di daughter of South Africa former president Jacob Zuma say her papa ready to comply wit di 15-month jail term wey di kontri Constitutional Court sentence am to, according to News24 wey dey quote Duduzile Zuma tweet. 

"Lockdown or no lockdown we go escort you to serve your time," she bin tweet. And say her papa "spirit dey high and im no get any fear".

Jacob Zuma former tok-tok pesin, Mzwanele Manyi, tell local tori pipo eNCA TV station say im believe say di sentencing go "shock" oga Zuma.

"If judges dey wey dey say dis judgment no dey constitutional, wetin you expect go be di attitude of [former] president Zuma?" oga Manyi tok.

Di jail sentence dey come afta di Constitutional Court of South Africa find am guilty of contempt unto say im refuse to show face for one official inquiry into corruption during im time as president.

During oga Zuma presidency, wey end for 2018, many allegations of mago mago against im administration plenty

One of di strongest accusation na say businessmen dey use padi-padi wit politicians to influence who and who go get contract.

Wetin di judge tok?

Acting Chief Justice Sisi Khampepe no hold back for her ruling.

Oga Zuma refuse to come to court to explain im actions, she tok, and e "choose instead to make provocative statements wey no get merit wey make up calculated effort to dirty di integrity of di judiciary.

"I no get anoda option but to commit Oga Zuma to imprisonment, wit hope say as I do dis, e go send strong message... di rule of law and di administration of justice na koko."

Di former president no dey court to hear di ruling and bin don declare time and time again say e be di victim of strong political conspiracy against am.

BBC tori pesin Andrew Harding say dis jail sentence mark dramatic turning point for di man wey bin dey prison about 50 years ago, for im role inside South Africa liberation struggle.

For anoda separate legal matter, Oga Zuma plead not guilty last month for im corruption trial wey involve $5bn (£3bn) arms deal from di 1990s.