DV-2022: US visa lottery advertisement in Nigeria na fake - US Embassy bin warn pipo

African immigrant - man and woman during citizenship ceremony for US

Wia dis foto come from, Getty Images

Di US Embassy in Nigeria don warn pipo about tori wey dey circulate about US visa lottery alias green card.

Inside informate dia '@USinNigeria' Twitter account post on Friday, dem say websites and messages wey dey fly upandan about visa lottery, all na 'fake'.

To find ogbonge informate about any of dia programmes, di US Embassy advice Nigerians to only check dia websites for ng.usembassy.gov and travel.state.gov.

Visa 'DV' lottery na citizenship program wey pipo from oda kontris fit use get American passport.

Application for di current one - DV-2022 open from 7 October, 2020, and e close on 10 November di same year.

For many years, di lottery dey very popular for di West African kontri, wia by 2000s, wia many believe say dia life go better once dem travel out permanently.

And so wetin make US get confidence say all di visa lottery announcements na fake? We need to travel back to 2014 when America ban pipo wey dem born for Nigeria to follow participate.

US warn Nigerians about fake 'visa lottery' informate

Wia dis foto come from, US Mission Nigeria

Why US stop di lottery for Nigeria

Diversity Immigrant Visa program, alias green card lottery na annual programme wey di US goment start for 1995 to allow non-citizens to get permanent residency card (PR)

Dis PR status (or to hold green card) na im go come lead to full citizenship and every year na about 680,000 immigrants dey become US citizen.

But for 2014, di US announce say Nigeria no go dey eligible again as from 2015, di following year. Dis mark di first and only African kontri wey collect di lottery ban.

Di reason for di ban na say Nigeria don reach limit: dis na when kontri send over 50,000 immigrants in each of di previous five years.

Immigrant from South America enter US

Wia dis foto come from, Getty Images

Kontris wey dem ban before fit get chance to come back, like e happun for Peru, Poland and some oda kontris. So chance dey say US fit lift di ban on Nigeria in di future.

Anoda kontri for Africa wey don dey reach limit small small na Ghana.

Before dia ban, Nigerian applications na im plenty pass for di world.

Although di application for di lottery na free of charge, many scam businesses dey, wey go charge pipo to 'help' dem win di lottery. Na dis kain pipo di US Embassy warn about.