Akwa Ibom Police arrest pastor wey allegedly kill and bury im wife

Ukachukwu Enoch Christopher

Wia dis foto come from, Akwa Ibom Police Command

Youths of Ikot Ataku community for Okon-Eket Local Government Area of Akwa Ibom state, South South Nigeria don destroy di poster of di Omega World Global Ministry (Fellowship Church) afta police confam say di founder of di church allegedly kill im wife.

Di Akwa Ibom State Police Command arrest Pastor Ukachukwu Enoch Christopher on top accuse say e kill im wife and bury di corpse for shallow grave inside di compound e dey live.

Police tok tok pesin, Odiko Macdon for inside statement say dem arrest di 49 year old pastor on 16 June, 2021, meanwhile, di incident happun a week before.

According to di police, di suspect bin get domestic palava wit im wife, Mrs Patience Christopher as e accuse her of cheating and claim say na she be di source of im problem.

Mama Patience wey be 40 years old get five children for di pastor.

E confess to di police say im beat her to death.

How dem discover di body

BBC Pidgin don visit di compound where Pastor Ukachukwu Enoch Christopher wey allegedly kill im wife dey live.

Di compound wey dey Ikot Ataku community na property wey im rent, e dey live for there wit im family, im church also dey there.

Many pipo bin full ground for di big compound to know wetin happun.

Caretaker of di house tell BBC Pidgin say na di second son first raise alarm say im mama dey miss and even give informate say e see some where dem dig as grave for di compound.

E begin investigate wetin happun and pipo tell am say di man no dey open gate for anybody. but im later go di house on top pretence say im come wit plumber to fix water.

"I call di man for fone, say I dey gate make e open for me. I go wit one man wey act as plumber, we bin go round di compound and we see some places dem dig, but I no sabi which one, so I alert young boys for di area. Dem enta di compound, search round. Dem see one place where dem use plenty plantain stems cover, as dem comot di stems, na so dem take discover di body and inform di police." di caretaker tok.

Di Police don exhume di corpse of Patience Christopher and deposit am for mortuary for autopsy as dem don begin investigation.