Level 2 lockdown: President Cyril Ramaphosa announce new restrictions for South Africa to contain Coronavirus

South Africa president dey collect vaccine

Wia dis foto come from, CYRIL RAMAPHOSA/TWITTER

Read am in 3 mins

South Africa goment don place di kontri on 'Adjusted Alert Level 2' wit effect from Monday, 31 May as cases of coronavirus continue to dey rise for di kontri.

President Cyril Ramaphosa give di announcement wen e dey follow kontri pipo tok on Sunday.

E say over di last seven days, di kontri dey witness average of 3,745 daily new infections.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Under di adjusted level, di new curfew hours go be from 11pm to 4am plus bars, restaurants and fitness centres must dey closed from 10pm. Dis na to allow their employees and patrons fit reach house before di curfew start.

Other restrictions include:

  • All gatherings go dey limited to a maximum of 100 pipo for indoors and 250 pipo outdoors. If di venue dey too small to carry these numbers wit correct social distancing, then dem fit use 50 per cent of di capacity of di venue. Dis apply to all kain gatherings: religious services, political events and social gatherings, as well as restaurants, bars, taverns and similar places.
  • Face mask still dey compulsory at all times in public space. Na criminal offence not to do so.
  • Funerals go remain restricted to no more than 100 pipo, and as e dey before, night vigils, after-funeral gatherings and 'after-tears' gatherings no dey allowed.
  • If you test positive for COVID-19, you must self-isolate for house for a period of 10 days from di time you first develop symptoms. If you meet wit pesin wey get COVID-19, you must also self-quarantine for a period of 10 days afta your exposure, even if you no show any symptoms.

Cases of coronavirus for South Africa

Number of confirmed cases of coronavirus tanda for 1,659,070 and 56,363 pipo don die sake of di virus according to data from John Hopkins University.

President Ramaphosa wey express fear of thrid wave of di virus say provinces of Free State, Northern Cape, North West and Gauteng don dey reach di third wave of infections.

Na mata of time of time before di whole kontri enta di third wave, e add.

He say di number of pipo wey test positive to COVID-19 bin double that of last month from around 4 per cent to more than 11 per cent, even as di kontri don increase testing.

Vaccination programmes for South Africa

960,000 pipo for South Africa don collect one dose of vaccine.

More than 67 per cent of public health workers don dey vaccinated.

Two weeks ago, dem start di second phase of di vaccination programme, wey target di balance of health workers and dos wey dey 60 years and above.

Reactions to di new restrictions

Plenty reactions don follow di new restrictions wey goment announce as Hashtags Level2lockdown and FamilyMeeting begin dey trend for South Africa social media.

As some residents tok say dem no want anoda lockdown, others no see any difference for di new rules.

Twitter users reaction to di South Africa adjusted level 2 covid restrictions

Wia dis foto come from, TWEEPS

Twitter users reaction to di South Africa adjusted level 2 covid restrictions

Wia dis foto come from, Tweeps

Twitter users reaction to di South Africa adjusted level 2 covid restrictions

Wia dis foto come from, TWEEPS