Benue State Latest News: Why #BenueUnderAttack dey trend for Nigeria Twitter

Govnor Ortom

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Read am in 2 mins

Plenti Nigerian pipo on Friday enta social media to trend #BenueUnderAttack sake of tori wey say gunmen kill 36 pipo for Benue state, but di police say di killings no happun and di tori wey dey make di round na fake news.

Tori be say pictures of 36 dead pipo wey gunmen allegedly kill for Katsina Ala local goment area of Benue state begin dey circulate on Twitter wit many pipo retweeting.

Dis make di kontri pipo dey para and begin to call di goment out ontop say killings don dey too common for dat part of di kontri.

But, inside one statement di Benue state police command tok-tok pesin, Catherine Annene say dia visit to di local goment reveal say di tori no be true at all.

She say dem no see any corpse or grave as e dey circulated ontop social media.

She add join say di command don depploy more officers to di area for routine patrols and surveillance.

Di goment tok-tok pesin earlier bin say Terve Akase also say suspected fulani herdsmen dey try to distabilize di state and dem di use some gangs to cari out dia plans.

E say di state goment don begin to recruit volunteer guards and dem go give dem approved weapon to defend demselves.

#BenueUnderAttack don get over 120,000 tweets

Plenti Nigerians wey include celebs for social media don condemn di killi-killi wey dey happun for Benue by suspected herdsmen with #BenueUnderAttack

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Katee Henshaw Tweet

Wia dis foto come from, Screeshot

Khafi Tweet

Wia dis foto come from, Screeshot

Why Benue be epicentre for Attacks?

Benue pipo and herders don dey live togeda for ages

But gbege come start wen di herders begin enta pipo farm to eat dia crops and di pipo in turn, begin kill di cows dem.

Di mata come pass becareful wen for 2017 -2018 herders attack plenti community sack di pipo come take over di place.

Sake of di plenti death, di goment do mass burial for those wey die and di situation lead to plenti outcry for di kontri including international community.

Those wey run from dia villages still dey live for IDP camp and di goment say dem reach close to 800 thousand of dem.

Why Attack even wit grazing law?

Afta di plenti killi-killi of Benue pipo, di goment for 2017 establish law to prevent open grazing for di state.

Dis wan mean say di goment want make all cow dey for ranch and no dey waka any how to destroy farms.

Although di goment say di law don epp reduce di frequency of attacks, di recent killi-killi don shock mani pipo for di state.

But di state govnor, Samuel Ortom recently tell di pipo say di goment go make sure e protect dem against any invasion.

Govnor Ortom for one interview wit BBC Pidgin tok say ''goment suppose give bandits same treatments aa ESN and IPOB''