Ebonyi bomb explosion tori for Afikpo no be true - Police

Wia dis foto come from, Getty Images
Ebonyi state police don deny say suicide explosion happun di south east state of Nigeria.
Tok-tok pesin for di police for di state explain say wetin happun no be case of bomb explosion but na officer gas grenade wey explode for im body.
Tori wey we bin hear na say suspected suicide bomber don blow imsef up for front of one school for Amaizu- Amangballa Afikpo, Ebonyi state but police say no be so, but dem loss dia officer for di incident.
But di Ebonyi police tok-tok pesin clarify say di man wey blow up today na police inspector and na im service tear gas grenade wey explode and kill am.
Police say di area dey calm now and no tension for ground.
"My attention don dey drawn to one news wey dey make di round for some section of di media say explosion happun for Afikpo, Ebonyi State dis afternoon." One statement from di Special Assistant to di Ebonyi state Govnor on Media and Publicity Francis Nwaze tok.Nwaze add say di tori of suicide bombing na lie. But na two of dat kain accident happun.
"Di incident na grenade of one security personnel wey dey carry out im duties for di location wey accidentally exploded. A similar incident also happun for front of di Ebonyi State Old Government House as some mobile police officers bin dey service dia APC machine.
Di first incident take di life of di bearer while di second cause injuries on di affected person, wey dey hospital, wia e dey currently receive treatment." Di statement tok.
End of Di one wey oda users dey read well well










