Israeli Palestinian ceasefire: Why Israel and Hamas cease fight and wetin fit happen next

Wia dis foto come from, AFP/GETTY IMAGES
Israel and di Palestinian militant group Hamas don agree to stop fight-fight.
Di ceasefire begin early on Friday, and e mark di end of serious, heavy fighting wia more than 240 die, most of dem inside Gaza.
Palestine pipo enter di streets of Gaza to rejoice after di announcement of di ceasefire comot, although one Hamas official warn say dem dey alert as dia hands still dey "on the trigger".
Both Israel and Hamas don claim victory inside di fight.
US President Joe Biden say di ceasefire go bring "genuine opportunity" for progress.
On Thursday, di day before di ceasfire, more dan 100 air strike from Israel land ontop Hamas properties dem for di north of Gaza. Hamas too respond wit rocket fire.
How di ceasefire agreement take happen?
As of late Wednesday, tok don dey comot small-small say Israel fit begin bow to pressure from international community, especially from kontris wey dem dey follow do padi-padi.
End of Di one wey oda users dey read well well
But even Hamas sef bin don get pressure to put dia rockets down.
On Wednesday, US President Joe Biden tell Oga Benjamin Netanyahu say "e dey expect am to end di tension today and begin di journey to ceasefire".
Egypt, Qatar and the UN also get major hand in di ceasefire afta dem follow Israel and Hamas tok.
President Sisi order say make two security committees go Israel and di Occupied Palestinian Territories to work towards di ceasefire, according to Egyptian state TV.
Wetin di two sides tok?
Di Israeli Political Security Cabinet said dem "unanimously accept di recommendation" to ceasefire.
Israeli Defence Minister Benny Gantz tok on Twitter say, di damage dem do for Gaza, dem give dia military di kain advantage dem never get before.
One Hamas official tell di Associated Press say, di ceasefire wey Israel announce na like "victory" for di Palestinian people and defeat for Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu.
Soon after di ceasefire wey begin on 02:00 on Friday (23:00 GMT Thursday), plenty Palestine pipo comot for street and roads to celebrate.
But Basem Naim, from di Hamas Council on International Relations, tell di BBC say im no too sure say di ceasefire go last.
"Without justice for Palestinians, without stopping di Israeli aggression and Israeli bad actions against our pipo inside Jerusalem, di ceasefire no go get solid foundation," im tok.
Meanwhile one Hamas political big man, Ezzat al-Reshiq, even tear warning give Israel.
"Na true say di battle end today but Netanyahu and di whole world suppose know say our hand still dey ontop di trigger," e tell Reuters news agency.
"We don tell Netanyahu and im army, if you come back, we go come back."










