How much be pure water [sachet water] price?: Why pure water prices dey rise across Nigeria
![How much be pure water [sachet water]?](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/13182/production/_118501287_howmuchbepurewater-sachetwater.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerians dey lament sake of di rise in cost of sachet water AKA pure water.
Plenty tok full town say di average amount don increase for a sachet or bag of water.
Di sachet water dey very common in many household across Nigeria.
Di packaged 50cl water inside small nylon bag dey serve as source of portable drinking water for many homes.
Many Nigerians sample opinion for BBC Pidgin Facebook page on how di price don rise across di west African kontri.
Leke Ajala tok say one bag na N150 from di depot wen retailers dey sell for N170 & N200.
And dis don affect di unit cost for Delta State, southern Nigeria.
Julius Sunset tell us say one bag na N200 and N20 per one in di state capital for Asaba.
End of Di one wey oda users dey read well well
Edogiawere Kinsley inside Imo State [eastern Nigeria] us say those wey wan buy pure water for east dey pay 250 per bag in Owerri.
![How much be pure water [sachet water] price?: Why pure water prices dey rise across Nigeria](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/58B6/production/_118501722_howmuchbepurewater-sachetwaterpricewhypurewaterpricesdeyriseacrossnigeria.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Other
Tachael Oyinye Udeh say for Abuja [di kontri political capital] and some part of di north, sachet water still dey sell for 10 naira.
She say na only south part of Nigeria di price hike dey.
Slyvia Oluchi dey para on top di increase in pure water price.
She say, "Since dis pure water enter 20 naira for my area I don go buy water bottle.
"Anytime I dey comot I put my water if e hungry me for road I drink.
"If e no hungry me I carry am come back home this country and it's corrupt leaders can not send me to an early grave".
![How much be pure water [sachet water] price?: Why pure water prices dey rise across Nigeria](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/21C0/production/_118504680_howmuchbepurewater-sachetwaterpricewhypurewaterpricesdeyriseacrossnigeria.jpg.webp)
Remember say pure water hawkers and street vendors been protest in Abuja for 2016 sake of the rise in cost.
Di protesters bin lament say one bag which dey always contain 20 sachets and which dem bin sell for N100 (Naira), dey sell for N150.
Dat time di wholesalers say di increase na sake of US Dollars wey scarce.
Shortly after di coronavirus in 2020 na im wholesalers of sachet water begin add money.
For Lagos, traders say na sake of say many factoris bin close during di lock down and dem no see raw materials take package di water.
Meanwhile, di Rivers state goment don direct water producers to reduce di price.
Dis na so dat pipo for di state go get access to potable water for cheap price.
Di Commissioner for Water Resources na im tok dis one.
Di state chairman of water producers association of Nigeria and di oga of bottle water producers say dem go gollow dia members tok ontop wetin dem go do next.




!["Nigeria constitutional review": [Senate wan review 1999 Constitution]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/2E20/production/_118480811_nigeriaconstitutionreview.jpg.webp)








