Eid-al-Fitr 2021: Places for Nigeria & oda kontries wey don celebrate Eid wey mark di end of Ramadan

Wia dis foto come from, Moon Sighting
Some places for Nigeria and some kontries don celebrate di Eid-el-Fitr today as Muslims for oda part of Nigeria and di world still dey wait to sight di Shawwal moon.
Before now, di Sultan of Sokoto declare say Thursday na Eid-al-Fitri for all Muslims to celebrate di end of Ramadan for Nigeria.
Dis announcement from Alhaji Sa'ad Abubakar III wey be President-General Nigeria Supreme Council for Islamic Affairs, mean say Ramadan fasting dey continue on Wednesday.
Places for Nigeria wey don celebrate Eid-el-Fitr
Bauchi

Wia dis foto come from, Facebook/Sheikh Dahiru Usman Bauchi/
Popular islamic cleric Sheik Dahiru Bauchi and thousands of im followers celebrate Eid al Fitr wey be Sallah on Wednesday despite say leader of Nigerian muslims Sultan of Sokoto instruct say na Thursday.
Di cleric belong to di Tijjaniya sect of islam and dem dey place higher respect to Senegal wia founder of di sect Sheik Ibrahim Nyass come from instead of Sokoto wia oda Nigerian muslims dey look to di Sultan.
Na one of di children of Sheik Dahiru lead di prayers while di cleric dey among di first queue of worshippers and after di prayer e tok say di reason dem observe dia Eid Wednesday na because dem don confam sighting of moon.
"Di rule for islam na say if two responsible pipo report say dem sight moon then you should listen to them and drop di fasting. Na wetin happun be dat. Our pipo report say dem sight moon for Gombe and Kebbi states."
Di cleric say dat na di reason why dem celebrate dia own Eid instead of waiting till tomorrow.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ibadan

Wia dis foto come from, Galaxy TV
Di Chief Imam of Ibadan land, Sheik Abdulganyu Abdukadir Agbotomokekere observe Eid-El-Fitri Prayer for Agodi Praying Ground inside Ibadan on Wednesday.
Report from local media say among those wey attend na di Oyo State deputy Governor, Rauf Olaniyan and di Olubadan of Ibadanland, Oba Saliu Adetunji.
Kontris wey don celebrate Eid-el-Fitr
Niger

Wia dis foto come from, Getty Images
Di goment of Niger Republic don announce di sighting of di Shawwal moon, bringing di fasting month of Ramadan to end.
Na di Niger Prime Minister Ouhoumoudou Mahamadou disclose dis one. E say reveal say dem sight di crescent for different regions of di kontri.
Di kontri celebrate Eid Al Fitr today, Wednesday.
Mali and Ivory Coast
According to Astronomy Centre, Ivory Coast and Mali also dey mark di first day of Eid today.

Wia dis foto come from, Twitter












