Oshodi market fire: Fire-fighters battle for Kairo to quench fire for di Lagos market

Kairo market
Wetin we call dis foto, Kairo market di morning afta di fire

Fire-fighters battle to quench fire wey burn for Cairo market for Oshodi, Lagos state south west Nigeria on Thursday night.

E no dey clear how di fire start.

Di Lagos state Emergency Management Agency later say dem finally put out di fire and no body die for di incident but fire burn plenti goods.

Dia tweet bin come as di federal fire service tok say dia men bin try battle to quench di fire and make pipo wey dey look clear road for dem to see chance to take battle di fire.

Kairo market as e dey burn

Wia dis foto come from, Federal Fire Service

Wetin we call dis foto, Kairo market as e dey burn

Wetin cause di fire?

We no know yet.

But our tori pesin wey visit di place tok say di fire start just before 8pm Thursday night, fire fighters battle with am till about midnight before dem quench am.

As at early Friday morning, access gate to di market still dey locked by market security pipo as dem dey try to avoid hoodlums from looting shops wey no dey affected.

Plenti shop owners and sympathizers gather outside di market gate since Friday morning dey wait to access di tins fire no burn.

Kairo market in di morning afta di fire
Wetin we call dis foto, Kairo market in di morning afta di fire

As at press time, one police van dey outside di gate with police officers inside to maintain order.Kairo market na major clothing materials market for Lagos and e dey also house shops wey dey sell shoes and bags.

Kairo market in di morning afta di fire
Wetin we call dis foto, Kairo market in di morning afta di fire as pipo gada to check out di damage
Kairo market fire

Wia dis foto come from, Other

Kairo market fire

Wia dis foto come from, Other

Our eye still dey dis tori. Make you refresh to get more info as we dey get them.