Ebonyi state news: Umahi conclude Ebubeagu launch plans to tackle unknown gunmen attacks

Wia dis foto come from, EBONYI STATE GOMENT/FACEBOOK
Ebonyi state don prepare ground for di launching of di regional security outfit Ebubeagu Eastern Security.
Dis na as 'unknown gunmen' never stop to terrorize di state wey tanda inside eastern region of Nigeria.
Dave Umahi, di state govnor, for dia security council meeting display commanders of Ebubeagu for di thirteen local goment areas.
Di security council also agree to form wetin dem call Joint Youth Vigilante Committee for communities wey don experience communal clash.
But for di Ebubeagu to work well, di Ebonyi state security council issue directives wey dem don mandate police to enforce.
Di directive dey inside statement wey Orji Uchenna Orji, Commissioner for Information and State Orientation, Ebonyi State release.
According to Orji, di reason for launching Ebubeagu na "on recent Killings for di state.
"We direct security agencies say dem must do everything possible to bring perpetrators to justice.
End of Di one wey oda users dey read well well
"And must deepen collaborations and professionalism to fight di ravages of insecurity for state".
Oda decisions by Ebonyi government
All native doctors and traditional medicine dealers for di state must register within seven days as part of security measures for di state.
Dem need to register with di Commissioner of Police, Commissioner for Health and Commissioner for Internal Security and Border Peace.
All wake keep activities for di state must end by 6pm - Ebubeagu and Security Agencies must enforce di wake keep restrictions.
And defaulters must pay fine of One Million Naira (N1,000,000.00).
Night clubs must not operate beyond 6pm.
Curfew don dey for all di border points wey dey connected to other states from 8pm to 6 am with effect from wednesday, 28th April, 2021.

How Ebubeagu go operate
Di state goment security outfit, Ebubeagy go address all di situation for Ebonyi.
Commissioner for Internal Security and Conflict Resolution for Ebonyi state, Stanley Okoroemegha for interview wey im get wit BBC say
Okoroemegha say di goment dey first put Law for ground in conjunction with oda South eastern states.
Di law na for how dem go operate di outfit, im tok.
Some of di operational pattern be say;
Ebonyi state goment plan to recruit up to 2000 personnel for Ebubeagu.
Di 2000 go get 100 pesins from each of di 13 LGAs of di state.
While dem go deploy di remaining for di state capital and odas for di zone, di commissioner yan.
Already, di state goment don approve recruitment of commanders of Ebubeagu for di 13 LGAs.

Wia dis foto come from, ODA
Authorities recruit dem after police DPOs, DSS, traditional ruler and pastor screen dem reach dia house.
Security agencies especially police and DSS go profile all di applicants before goment go recruit dem.
Dem go do di profiling in accordance with di Law and cooperation with di Christian Association of Nigeria.
Personnel of Ebubeagu go carry arms but di Law go determine di kain arm dem go carry.
Personnel of Ebubeagu no go fit make detain suspect - dia work na to provide security agencies with credible information wey go help avoid any attack.
Herbalist wey no register with police no go fit operate for Ebonyi state.
Dis na because goment go assume say any herbalist wey no register dey do 'odeshi' for unknown gunmen.
Unknown gunmen continue attack for South eastern Nigeria

South eastern Nigeria don dey for news for many weeks sake of reports of attack by unknown gunmen wey dey terrorise di region.
Despite di announcement of di commencement of Ebubeagu regional security outfit for South eastern Nigeria jaguda boys never still stop dia attack.
Some states for di region including Abia, Ebonyi and Anambra don already place partial curfew for border towns and some communities wey di unknown gunmen don worry too much.
Police confam attack on Naval checkpoint for Anambra

Wia dis foto come from, EMENIKE EMETOBI/FACEBOOK
Unknown gunmen attack one Naval checkpoint near Enamel Ware Junction for Onitsha - Owerri Highway Anambra State, police don confam.
Di number of casualty for di attack no dey clear but tori be say the unknown gunmen engage di Naval officers for shootout.
Toktok person for Anambra State Police command Tochukwu Ikenga tell BBC say , who confirmed the incident to newsmen on Wednesday, said that the command sent a response team to the scene after it received a distress call that there was sporadic shooting in the area.
Dis dey happen few days after unknown gunmen kill nine persons including women and children for in Ukpomachi village, Awkuzu, Oyi Local Government Area of di state, wey make students of Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University (COOU) wey dey live for di Igbariam campus run comot for fear of reprisal.
Jaguda pipo burn anoda Police station for Abia State

Wia dis foto come from, BBC Sport
Some jaguda pipo use fire attack Nkporo Police Station for Ohafia Local Government Area of Abia State.
Tori be say di jaguda pipo enter Nkporo early morning of Wednesday April, 28 where dem catch di police officers off guard.
Toktok person for Abia state police Geoffrey Ogbonna for statement say "dem no burn di Nkporo police station for Ohafia LGA. Rather some common criminals wey dey hied for bush take advantage of di morning rainfall and attempt attack on di station but were repelled. So dem throw explosive for di charge room wey cause damage to di counter, chairs and benches inside di station.
"Dem burn one unserviceable Police motorcycle outside, break wind shield of di patrol van and tiff two exhibit motorcycles. Nobody wunjure and Station building still good."
Unknown gunmen shoot for Owerri Imo state
Some unknown gunmen on Wednesday evening carry attack enter Owerri again, di Imo state capital.
Di motive of dia attack dey unknown but social media video show dem as dem position for Umuodu spibat Owerri.
Stray bullet from di shooting of di gunmen touch one man wey dey beside Rochas Okorocha Spilbat Mansion, Owerri - di man later die.
Police for Imo state never react to di incident.












