Fuel scarcity Abuja: NNPC dismiss long queues for petrol stations inside Nigeria capital - Fotos

Fuel scarcity no dey Abuja, na wetin Nigeria goment oil company dey deny as petrol queues show again for di Nigerian capital.

Tori be say plenti filling station no sell fuel to motorists and those wey dey sell, you go see motorists line up for hours to get fuel as at Tuesday.

Some of dem wey yarn wit BBC Pidgin on Monday say dem gatz wait for plenti hours and waste plenti time before dem get fuel.

Some say dem wait for nearly 8 hours.

Taxi drivers wey join line say dem no fit do business to give dia family dem chop moni.

See [Fuel scarcity Abuja] fotos

Fuel scarcity Abuja:
Wetin we call dis foto, Dis na di scene for filing stations for Abuja, as if to say fuel mata go soon start to red
Fuel scarcity Abuja:
Wetin we call dis foto, Cars wey queue bin cause hold up for Abuja

Dis long lines na sake of di di threat by Petrol Tanker Driver to go strike on Monday.

But afta di oga kpata-kpata of NNPC, Mele Katrina yarn wit dem, dem suspend di strike.

E also announce say dem no go increase di ex depot price of fuel for di month of May.

E say fuel full ground brekete And no need for panic buying.

Fuel scarcity Abuja:
Wetin we call dis foto, Cars wey queue for Abuja na because of fear - FG
Fuel scarcity Abuja:
Wetin we call dis foto, Nigerian goment tok say fuel no scarce say pipo dey do panic buying