420: 'Happy 420 meaning' as Nigeria warn against Cannabis culture

420 cannabis culture day: "Happy 420" meaning as Nigeria warn against Cannabis culture

Wia dis foto come from, Getty Images

Happy '420' wey be Cannabis culture observance around di world today, no be something wey authorities for Nigeria go entertain.

Nigeria Drug Law Enforcement Agency [NDLEA] on 20 April 2021 sama warning say di Cannabis culture no dey tolerated for di west African nation.

Available record show say over 10 million pipo for Nigeria dey addicted to smoking weeds, NDLEA tell BBC.

On Tuesday alone, dem arrest one university female student, Rhoda Agboje and her boyfriend, Ifeanyi Nwankwo, wey dia work na to produce and sell cookies wey dem don add igbo [Cannabis].

420 cannabis culture day

Wia dis foto come from, NDLEA

Di goment office wey dey fight di use of hard drugs add say dis two suspects dey sell am to children and other members of di public for Abuja, wey no know wetin dey.

Nigerian laws dey against cannabis or any kain hard drug as e dey illegal to use am for di kontri, one tok-tok pesin of di agency, Femi Babafemi tell BBC Pidgin as 420 begin trend.

However, he admit say true-true di kontri of recent don see high cases for di number of pipo wey dey smoke weed and abuse drugs.

Oga Babafemi add say even plenty states for Nigeria like Edo; Ondo; Kano dey plant Cannabis, Marijuana and oda kain weeds wey dey illegal.

NDLEA dem dey fight against am. Di offical add.

[420 meaning] Wetin be Cannabis Culture?

420 cannabis culture day: "Happy 420" meaning as Nigeria warn against Cannabis culture

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, 420 dey trend for Nigeria social media and all over di world.

4/20 or 4:20 na cannabis culture slang for marijuana and hashish consumption.

April 20 don become di international counter culture holiday.

Na day wen pipo dey gada to celebrate and consume igbo alias Cannabis.

Many of dos kain events get political undertone as na opportunity to call for di legalization of weed.

For dat day, many marijuana users go protest and gada for public to smoke weed at 4:20 pm.

420: How e take start

Many tori don follow how 420 take start but di one wey carry weight among all of dem na dat of five high school students for San Rafael California.

For 1971, di five students — Steve Capper, Dave Reddix, Jeffrey Noel, Larry Schwartz, and Mark Gravich go meet by 4:20 pm by di campus statue of chemist Louis Pasteur to smoke.

420: Cannabis get any advantage?

One psychiatric expert wey follow BBC pidgin tok say, true true cannabis get him own medical advantage wey no dey popular for Nigeria but di risk plenty pass di benefit.

E tok say person fit use am grow hair and increase appetite afta dem don process am but no be as dem dey grow and use am raw for Nigeria.

Dr Olajide add say e go dey difficult to control di use of cannabis for Nigeria if dem legalise am sake of corruption and indiscipline