Prince Philip Duke of Edinburgh: President Muhammadu Buhari join world leaders, send condolence give Queen Elizabeth II

Wia dis foto come from, Reuters
Monarchs, heads of state and PMs across di world, both past and present, don dey send ogbonge tributes afta di death of Prince Philip, Duke of Edinburgh, at di age of 99.
Spain king and queen send telegram to "Dear Aunt Lilibet" to mourn di passing of "Dear Uncle Philip".
Along with tributes from Europe royal households, many Commonwealth nations praise im exceptional public service.
Dem pay tribute to a life of duty, purpose, and devotion to di Queen.
US President Joe Biden also send condolences, as e hail di duke World War Two service, im environmental activities and charitable concerns, e add say: "He was a heck of a guy... 99 years old, e never slow down at all."
All living former US presidents also send ogbonge tributes.
Prince Philip, Queen Elizabeth II husband, die at di aged of 99, Buckingham Palace announce.
Di duke accompany im Queen during hundreds of dia overseas visits.
End of Di one wey oda users dey read well well
UK Prime Minister Boris Johnson, for im tribute to Prince Philip tok say, "By all measure Prince Philip live extra-ordinary life. We remember di Duke... above all for im steadfast support for Her Majesty di Queen."
Nigeria
Nigeria President Muhammadu Buhari join oda world leaders to extend condolence to Her Majesty di Queen over di death of her husband Prince Philip.
For inside statement, President Buhari say: "Di death of di Duke of Edinburgh na di end of an era. Prince Philip na one of di greatest and publicly recognisable international figures wey im contributions to di Commonwealth go dey remembered for generations to come.
"Prince Philip na man for im own right wey make plenty contribution to philanthropic activities and charities especially for wildlife conservation and youth development programmes for more dan 130 countries."
WTO Director-General
"I dey sad by di passing of HRH Prince Phillip, Duke of Edinburgh. My condolences to HM di Queen, PM Boris Johnson and pipo of UK. Make I particularly condole HRH Prince William, Duke of Cambridge," Director General of World Trade Organization, Ngozi Okonjo-Iweala tok for tweet.
South Africa
South Africa President Cyril Ramaphosa say, "Prince Philip na remarkable public figure wey live extraordinary life and wey pipo go always remember around di world."
Zimbabwe
"My deepest condolence to di pipo of di United Kingdom and di Royal Family on di death of His Royal Highness Prince Phillip", Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa tok.
Tanzania
Samia Suluhu, Tanzania new President, tweet say: "On behalf of di Government and di People of di United Republic of Tanzania, I convey my heartfelt condolence to you Your Majesty and through you to di pipo of di United Kingdom following di sudden demise of Prince Phillip.
Australia
"Him na special man wey represent generation wey we no go ever see again," Australian Prime Minister Scott Morrison tok for statement.
Belgium
King Philippe of Belgium bin send private message give Queen, and tok sey him for like tok with Her Majesty physically when e possible.
Malta
"I dey very sad by di loss of Prince Philip, wey make Malta in home and return here everytime. Our pipo go always treasure im memory," di Prime Minister of Malta, Robert Abela, write.
Lithuania
"For dis hour of dis kain heavy loss, my thoughts and prayers dey with you & di people of di UK," Lithuania President Gitanas Nauseda write to di Queen.













