Dolphin fish washed ashore in Ghana: Over 80 Ghana dolphins den fishes die from "stress" - Fisheries Commission

Wia dis foto come from, GRAPHIC ONLINE/FACEBOOK
Authorities for Ghana who dey investigate de circumstances wey cause dolphins den fishes to scatter along de shores of Ghana say preliminary investigations dey point to "stress" factors.
According to Head of Fish Health for Ghana Fisheries Commission, Dr Peter Zedah "initial investigations dey show say de fishes die sake of stress factors.
"For de exact stress factor dem still dey investigate" he add.
Meanwhile de Commission say dem dey conduct further tests which go help dem understand what happen.
De Fisheries Commission say some stress factors dey fit affect aquatic life like pollution, diet, water quality den tins - dis fit be possible causes of de stress dey fishes go through.
Ghana Ministry of Fisheries wan question dos wey chop di dead dolphins
Ghana ministry of fisheries don ask pipo wey chop di dead fishes wey scata for coast to show dia face so dem go fit help wit di investigation goment dey do.
Dis dey come days afta report say over 80 dolphins die for Osu beach and residents wey dey live for along di beach na dem first sight di dead dolphins.
Minister Mavis Hawa Koomson say goment wan closely monitor those wey chop di fish as dem still dey torchlight how di dolphins take die.
End of Di one wey oda users dey read well well
Authorities bin tell pipo make dem no chop di fish but some locals still go ahead to chop am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di minister yarn say dem don already carry samples go laboratory for investigations and di commission dey chook eye for di mata.
For inside tweet, she beg di local pipo to cooperate wit di commission.
Recently, plenti dolphins miss from Axim beach for Ghana and according to one Ghanaian news site Graphic Online reports, dem suspect say na pipo tiff di dolphins and dem mean to sell di meat.















